“I happy say I don enta Scoresheet” – Frank Onyeka don stop Brentford winless run wit em first Premier League goal

"I happy say I don enta Scoresheet" - Frank Onyeka don stop Brentford winless run wit em first Premier League goal
Share this

Brentford suppose dey thank their Naija star Frank Onyeka well-well after e help dem win 2-0 again Sheffield United, wey break their nine-game no-win run for Premier League match wey happun for Brentford Community Stadium."I happy say I don enta Scoresheet" - Frank Onyeka don stop Brentford winless run wit em first Premier League goal

The match, wey happun on Saturday, see Brentford dey find win wey go stop their recent bad-belle results, Hitvibz reports.

Meanwhile, Sheffield United wan collect points wey go helep dem stay for Premier League.

Brentford manager, Thomas Frank, choose to start Super Eagles star Frank Onyeka from bench, put three-man midfield formation for field.

Even though first half end without any goal, the tension knack for second half.

For 64th minute, Brentford break the deadlock with own goal by Ollie Arblaster.

Even though Mikkel Damsgaard score for five minutes later, referee cancel the goal because of foul before.

As Sheffield United dey press for equalizer, Brentford dey find to hold their lead and control the game speed.

Coach Frank con decide to bring Onyeka for 90th minute to add more ginger to the midfield.

Just three minutes after e enter pitch and with only two touches, Onyeka score Brentford’s second goal.

The Naija midfielder take advantage of the better pass wey Kevin Schade place for am to deliver sweet finish pass Sheffield United goalkeeper.

This goal no just seal important 2-0 win for Brentford but e also be Onyeka first goal for em club after 74 appearances.

The midfielder and em contribution for the match kuku show say Brentford get strong determination to turn things for their side.

Frank Onyeka don give em team small hope future performance for Premier League after em play important role to end Brentford no-win run.

You like this post? Abeg, we go happy well well if you fit drop your comment for the box wey dey down!

About the Author

Kris
An educationist, who loves good music and Football. A creative writer, footballer and content editor.

Be the first to comment on "“I happy say I don enta Scoresheet” – Frank Onyeka don stop Brentford winless run wit em first Premier League goal"

Leave a comment

Your email address will not be published.


*


This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.