Na Ibrox Stadium wahala dey Saturday as Nigerian defender Emmanuel Fernandez continue dey do him thing.

Emmanuel Fernandez celebrating his second Scottish Premiership goal

Na him goal give Rangers edge wey dem need to carry 2-1 win over Livingston for Scottish Premiership, Round 13, na weytin hitvibz yan be dat

Emmanuel Fernandez Burst Head, Rangers Chop Sweet W

The 24-year-old don dey fire well-well — 8.4 match rating, guy na correct MVP. The header wey em knack for 9th minute put Rangers front.

But wahala no end there — Livingston no gree lie down, Tete Yengi balance matter by scoring 18th minute, make score 1-1.

But true Champions no dey carry last. 12 minutes to finish, Mohamed Diomande knack winner. Initially VAR wan call am offside, but after review, e show say goal na correct.

  Paul Onuachu turn from hero to heartbreak as Trabzonspor manage draw with Antalyaspor

Rangers gather four wins from four since new oga Danny Rohl land, and Fernandez don show say even wey dem dey bench am sometimes, when opportunity show, na him dey deliver.

This na Emmanuel Fernandez second goal for season, him first na for League Cup Round of 16 against Alloa Athletic back August 16.

Danny Rohl come praise players, talk say win sweet but e still dey see small areas wey dem fit improve.

Emmanuel Fernandez scores his second goal for Rangers

Half-time tweak wey Rohl make na him help Rangers carry three points home. Now dem dey 4th place, nine points behind leaders Hearts.

Godwin Turn Baniyas to Monster, Shock Sharjah 4-1

Over for UAE Pro League, Super Eagles star Saviour Godwin na real wahala for Sharjah. FC Baniyas carry him style shock Sharjah 4-1.

  Super Eagles Don Ready to Defend Dia Trophy for 2026 Unity Cup for London

Saviour Godwin scores

Sharjah start match like say na dem be boss, dey hold ball 72% and dey fire 27 shots.

But na so na counter attack go dey dangerous. Early, Leonel Wamba knack two goals from quick breakaways, force Sharjah dey chase match.

After half time, na Saviour Godwin dey run show. Sharjah dey push forward, Godwin just dey find space like cat for corner.

Na him drive enter box, win penalty, convert am calm for 60th minute. That goal break Sharjah confidence comot. After that, every Baniyas attack dey look like e go end with another punch.

Saviour Godwin celebrating his goal

Youssouf Niakate add fourth goal, and Igor Coronado try small score consolation for Sharjah from spot, but e no dey enough — Baniyas carry day waka 4-1.

  Paul Onuachu Continue Em Hot Form, Tear Net Two Times as Trabzonspor Scatter Kayserispor

Godwin na real playmaker, guy dey hot for counter!

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on November 23, 2025 10:37 pm by Hitvibz Media