The Falconets of Naija just show say dem no dey play as dem use style hammer Ghana Black Princesses 3-0 for their WAFU B U20 Girls Cup third match for Benin.
The girls no waste time at all. Janet Akeremkowei first jaga with one long-range freekick wey make everybody shout “Omooo, this girl sabi!” 17 minutes enter the game, Naija don show 1-0 lead sharp sharp, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Goals Don Rain for Falconets for Nigeria
Na so Alaba Olabiyi follow waka come double the lead. Just 7 minutes later, she tap header wey come her way inside goal post like she dey shoot Fifa tournament for PS5, keeper no even see ball. 2-0 dey hang for scoreboard as first half end.
Falconets Still Dey Flow
After small water break, dem come chop more space for pitch. 16 minutes after second half start, Kareem Ramotalahi show say Naija sabi play ball as she make am 3-0.
Ghana no fit catch breath, dem dey waka go everywhere like person wey dey chase last bus.
These Falconets girls dey show strong form, teamwork tight like pounded yam wey no dey break. Dem steady maintain winning streak, gbaladun style, as dem waka enter semifinal for Benin.
Naija fans dey already dey dream of trophy, Ghana sef just dey shake head, e be like Naija don show say we be queen for girls football for West Africa.
The Naija U-20 Women dem still be di favorites for di tournament as dem never lose any match yet.
With dis result now, di Falconets don win all three of dia games, still dey clean with perfect record.
Falconets start the tournament well as dem knack Black Princesses 3-1, come follow am up with solid 3-0 win against Benin wey dey host am.
Till now, Naija girls don score nine goals for three match, dem con only collect one.
Next up, di Falconets go jam di Young Amazons from Benin tomorrow by 10:00am.





Be the first to comment on "Falconets Hammer Black Princesses of Ghana 3-0 for WAFU B U20 Girls Cup"