Na so our U20 babes, the Falconets, knack final finish for the 2025 WAFU B U20 Girls Cup as dem wire Benin Republic 1–0 for inside their own backyard — Omnisport Stadium for Adjohoun.
Dem no just win trophy, dem collect am with swag and unbeaten record join body, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Falconets Seal Dominant Run with Another Confident Display
Even before ball start roll, everybody don sabi say na Nigeria get this cup. But our girls no still dull — dem enter pitch with serious face like person wey wan collect salary early.
From kickoff, na the Falconets dey call the shots. Benin girls just dey chase shadow like say dem dey play hide and seek.
By 16 minutes, wahala don happen — Ramotalahi Kareem no gree! One kind waka-waka ball jam inside box, she pounce am like hungry cat and fire am go net. Goalkeeper just look am pass, 1–0 sharp sharp!
Benin try show muscle second half, but e be like say dem forget say na Naija dem dey play. Our defense solid like block wall, midfield dey control game like DJ for club — no space for Benin to dance.
Four Wins in Four Matches for the Unstoppable Falconets
When ref blow final whistle, na celebration everywhere. Four games, four wins — dem score 10 goals, only allow one enter their net. Abeg who wan try these girls?
Dem play football wey sweet like Sunday jollof — teamwork dey, confidence dey, swag dey. The kind pressing wey dem do ehn, even Premier League boys go learn from am.
This win no be ordinary one o — e just remind Africa say Nigeria no dey carry last when e reach women football. Falconets go come dey talk say, “If una no fit beat us, just join us!” 😁😂
Naija for life!




Be the first to comment on "Falconets Show Benin Pepper as Dem Finish WAFU B U20 Run Without Scratch"