Super Eagles Don Finish AFCON 2025 Group Stage With 3-1 Win Over Uganda

20251230 1756382

Super Eagles of Nigeria don finish their AFCON 2025 group stage with beta performance as dem beat Uganda 3-1 on Tuesday evening. Na strong finish be that, as Nigeria collect full three points with confidence.

From kickoff, Nigeria control the game well, dey move ball sharp sharp, dey pressure Uganda defence until dem finally break through for first half, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Super Eagles Open Score Through Onuachu

For 28th minute, Fisayo Dele-Bashiru run enter from left side come square ball give Paul Onuachu. Onuachu no waste time — e place am calmly pass goalkeeper Oya score him first goal for the tournament.

  Genk Oga Don Blow Horn for Tolu Arokodare: "First Super Eagles Call-Up Na Just The Start, More Goals Go Land"

That goal give Super Eagles 1-0 lead enter halftime after better first-half display.

Onyedika Double Finish Work For Super Eagles

Matter come easy for Nigeria when Uganda goalkeeper Magoola collect red card, leave dem with ten men.

Na there Raphael Onyedika take over show. For 62nd minute, Samuel Chukwueze thread fine pass break Uganda defence, Onyedika just push ball pass goalkeeper leg make am 2-0.

Before dem fit recover, five minutes later, Onyedika score again. Another clean move with Chukwueze assist, Onyedika finish am well make score 3-0.

Na quick quick two goals for him — first start under coach Eric Chelle, first match, two goals sharp sharp.

  Terem Moffi don scatter em 389-day drought, drag Nice enter Champions League with em goal against Brest

Uganda later score one goal for 75th minute through Roger Mato, but e no change anything as Super Eagles control game till final whistle.

Match Summary Sharp Sharp

Raphael Onyedika score two goals

Paul Onuachu score one

Samuel Chukwueze give two assists

Fisayo Dele-Bashiru give one assist

Nigeria don score eight goals for group stage, concede four. Dem score for all matches but no keep clean sheet.

Six different players don score for Nigeria for AFCON 2025 so far, including Victor Osimhen, Ademola Lookman, Semi Ajayi, Wilfred Ndidi, Paul Onuachu, and Raphael Onyedika.

  Akor Adams, Ejuke don shout “we ready” for AFCON 2025 as dem score, assist, help Sevilla enjoy big win

Now Super Eagles go face knockout stage with full confidence and attacking ginger.

Like this post?
We’d be delighted to hear from you. Please leave a comment in the box below!

Last Updated on December 30, 2025 8:26 pm by Hitvibz Media

About the Author

Hitvibz Media
An educationist, who loves good music and Football. A creative writer, footballer and content editor.

Be the first to comment on "Super Eagles Don Finish AFCON 2025 Group Stage With 3-1 Win Over Uganda"

Leave a Reply