My people, wahala don burst small for Super Eagles camp o! Coach Eric Chelle don finally open the paper wey carry Nigeria squad for the World Cup playoff wey go happen for Morocco — and na two names dey scatter everywhere: Maduka Okoye and Chidera Ejuke don bounce back like say dem no even miss road!
Chelle no wan spoil wetin dey work — him still carry most of the boys wey flog Benin 4–0 last month. The man dey reason say, if e never spoil, no touch am, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Maduka Okoye Don Return — Case Closed
Bros Maduka don finally return after him long sabbatical wey resemble exile. The Udinese keeper don serve him time after that small wahala for betting side, but now e don clean him slate, ginger don full him body.
The bobo even show small sign of life when him keep post for Udinese vs Cremonese — 1–1 draw wey end him near five months of waka without ball.
Now, Chelle don look am say, “Maduka, your head don correct again, abeg come hold post.” Omo, the fight for Super Eagles number one jersey go hot pass Lagos traffic!
Ejuke Don Come Back From Body Palava
As for Chidera Ejuke, na small small injury dey whine the boy since last year, but now e don bounce back. The winger wey sabi run like say him dey chase okada thief go give the wings fresh pepper.
Chelle sef dey happy — he talk say Ejuke go add more wah to the attack. Pace, dribble, small shakara — na wetin Super Eagles don dey miss.
Meanwhile, Semi Ajayi still make the list, but e go sit down for Gabon match because suspension don hold am like police checkpoint.
Full Super Eagles Squad — See As Dem Set!
Goalkeepers:
Nwabali Stanley • Obasogie Amas • Okoye Maduka
Defenders:
Ekong William • Bassey Calvin • Bright Osayi-Samuel • Onyemaechi Bruno • Semi Ajayi • Chidozie Awaziem • Sanusi Zaidu • Fredricks Benjamin
Midfielders:
Iwobi Alexander • Onyeka Frank • Ndidi Wilfred • Onyedika Raphael • Yusuf Alhassan
Forwards:
Lookman Ademola • Moses Simon • Osimhen Victor • Arokodare Tolu • Ejuke Chidera • Akor Adams • Olakunle Olusegun • Chukwueze Samuel
Super Eagles Don Sharpen Boots For Morocco
The boys go face Gabon, DR Congo, and Cameroon — no be beans o! After dem manage pass Benin to reach this level, now na do-or-die matter for Qatar 2026 ticket.
Chelle don talk say the team don balance — defense get bone, midfield get sense, attack get thunder. If the boys fit play like dem play for that Benin match, omo, even Cameroon go hear am!





Be the first to comment on "Maduka Okoye, Ejuke Don Show Face Again as Chelle Drop Super Eagles Squad for World Cup Playoffs"