Baba Paul Onuachu don still dey scatter nets for Turkey o! The big striker score again for Trabzonspor, but e still no reach to give dem victory as Alanyaspor come drag dem 1–1 draw for Papara Park on Saturday.

Paul Onuachu

See life — man dey form goal machine for Turkey, yet Super Eagles coach Eric Chelle no still call am for the World Cup playoff against Gabon, na weytin hitvibz dey yan be dat.

But Onuachu no talk too much — e just use another goal reply am like “Coach, you dey see me abi you no dey see me?”

Paul Onuachu Show Say E Still Get Fire After Super Eagles Snub

From early minutes, the guy just show say him no dey play. Na him open scoring for 15th minute — cool finish like person wey dey sip malt after jollof rice. Trabzonspor dey ball well that first half.

Paul Onuachu celebrating his 8th Super lig goal

Onuachu dey hold ball like bouncer wey no dey gree anybody pass, Alanyaspor defenders just dey chase shadow. But as dem no fit add another goal before half-time, wahala still dey.

  VAR wan crase? Cyriel Dessers tear net, assist as Rangers show Jose Mourinho say no be by gra gra

Hagi Burst Bubble, Spoil Party for Trabzon Fans

Second half come change pattern. Alanyaspor come dey ginger, match balance small.

Then boom — Ianis Hagi, son of legendary Gheorghe Hagi, just knack one fine goal for 73rd minute. The whole Trabzon stadium quiet like NEPA take light.

Paul Onuachu scores his 8th Super lig goal

Trabzonspor try press again, Onuachu even dey vex say nobody dey supply am ball. But na lie lie — dem no see another goal. Final whistle blow, frustration full everywhere.

The draw don make Trabzonspor slide from second go third for table. Dem and Fenerbahçe now dey tie on 25 points, four points behind table-toppers Galatasaray. Na small mistake dey separate champions from “next time.”

  "E no important" — Ademola Lookman cool down Osimhen attitude gist after Super Eagles scatter Mozambique

Onuachu’s Hot Streak Still Dey Boil

This new goal don make am eight goals plus one assist this season. Bros no dey calm down o — e dey carry Nigeria name high for Europe.

Even though Chelle blank am this time, the guy dey force everybody to reason say e deserve that Super Eagles call-up next time.

Paul Onuachu celebrating 8th Super lig goal with teammate

For the match, smallie Uchenna Ogundu from Naija enter for Alanyaspor around 70th minute, while another Naija pikin wey grow for Belgium, Kazeem Olaigbe, also show face for Trabzonspor side.

After international break, Trabzonspor go jam Başakşehir. Dem go need bounce back sharp-sharp, or else people go start yarn say their early season fire don turn warm water.

  Which Super Eagles Players Don Ready for AFCON 2025 — and Who Still Far Like Oshodi to Kano?

Bros Onuachu no dey dull. The guy dey score like say net offend am. Make Chelle open him eyes — this kain striker no dey waka pass for market twice!

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on November 8, 2025 5:46 pm by Hitvibz Media