Super Eagles forward Umar Sadiq don show say him be bad man again. Him prove him value when everywhere red as him rescue Valencia CF for their La Liga match against Athletic Club on Sunday afternoon.
The Naija international enta from bench come score the winning goal, as Valencia carry 0–1 victory run commot for Estadio de San Mamés, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Umar Sadiq shock Athletic Club for Bilbao with sharp-sharp impact
The match bin still dey 0–0 after the two teams waste plenty chances. Na so dem carry Sadiq enta for 70th minute make him replace Hugo Duro, wey bin don miss one correct chance to give Valencia lead.
Just two minutes after him step leg for pitch, Sadiq show dem pepper. Him score the winning goal—the boy second goal inside him last three matches for the club.
For this Round 36 game, the 29-year-old striker nack him fourth La Liga goal for the season.
If you count all him work, him don involve for eight goals: four goals and two assists for league, plus two goals for Copa del Rey.
Los Che finally end their long 16-match “no-win” record for Bilbao, and this win don give dem small breathing space as dem dey fight to commot for relegation zone.
The visitors start the game with vawulence, dem scatter Athletic Bilbao plan early and no gree the hosts settle at all.
Even as Athletic try come back for the game, their main men no fit do anything. Nico Williams struggle well-well to pass the person wey dey mark am.
The first real chance fall for Oihan Sancet leg, but him blow the ball wide.
Super Eagles striker show level as him commot from bench for Los Che
Though Valencia no too attack, dem make life hard for Athletic. Dem even get penalty when Yuri Berchiche nak Hugo Duro down. But Duro go carry the ball nack bar.
Athletic come get wahala as Nico Williams wound, so him brother Iñaki come replace am.
Second half get small ginger but correct chances no plenty. Iñaki Williams try test Stole Dimitrievski, but the goalkeeper catch the ball coolly.
When 20 minutes remain, Los Che make three changes at once—and the thing work sharp-sharp. Largie Ramazani start one counterattack, and Sadiq use head nack the winning goal enta net.
Athletic try their best for die-minute, but José Gayà stand gidigba for defense to help Valencia hold the win.
This result keep Los Che for 12th position, six points away from relegation, while Athletic still dey 9th with three matches left to play.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on May 10, 2026 6:24 pm by Hitvibz Media
Related
Umar Sadiq turn hero as him late goal help struggling Valencia break Bilbao curse


Stay connected