Victor Osimhen say him go put body, soul, spirit make Naija reach World Cup after e bag two vs Gabon
My people, our guy Victor Osimhen don open mouth again gbagam, say him dey fully focused on carry Nigeria reach that 2026 World Cup.
After the Super Eagles knack Gabon 4–1 for Rabat, with Osimhen bag two goals like say na small chops, the Galatasaray hitman come yarn us how him dey handle pressure, miss chances, and still shine when e matter pass, na weytin hitvibz dey yan be dat.
How Victor Osimhen Take Dey Handle Pressure for Big Match
When dem ask am how e dey survive under pressure, Osimhen no even form superstar. E just talk am like person wey dey gist for beer parlour.
He say, “See ehn, I don play this ball taya. I don face some teams wey fit make person stomach turn. Sometimes I go score goal wey person no expect, sometimes I go miss chance wey mama put believe on top. But e no dey shake me.”
The guy talk say as long as match never end, he dey always ready correct any gbese.
He even yarn say, “I tell my guys sorry first, but I promise dem say I go correct am for extra time. And I deliver. Big shout-out to who give me the assist—una too try.”
And true-true, those two extra-time goals na the turning point wey change Nigeria body language. The guy show resilience like say e be captain wey carry lion heart inside boot.
Osimhen still hail the team, talk say dem mentality strong.
“We deserve this win. Gabon sef no be anyhow team, dem get quality. But today na our day.”
He come salute Naija fans everywhere, “Una wey believe for us, una be real MVP. This win na for una.”
But he warn say next round go hot like Maiduguri sun.
Osimhen Send Emotional Message to Nigerians Ahead DR Congo Showdown
Ahead Sunday wahala against DR Congo, Baba Blue Eyes (Osimhen) drop emotional message give Super Eagles supporters.
He say, “We know say no be everybody go support us, but the fans wey stand gidigba for our back—God go bless una. We dey see una love, online and real life. This win na for una.”
He come seal am with ginger:
“From here na greatness. We go put everything for ground to make una proud and qualify for this World Cup. E no go easy but we dey ready.”
Osimhen Last 6 Matches for Super Eagles — Form Wey No Get Respect for Anybody
⚽️⚽️ vs Gabon
⚽️⚽️⚽️ vs Benin
🅰️ vs Lesotho
🤕 vs Rwanda
⚽️ vs Zimbabwe
⚽️⚽️ vs Rwanda
The guy don turn goal machine. Osimhen now get 31 goals in 45 matches for Nigeria. Just seven goals remain make he equal the all-time top scorer record.
If em form continue like this, na this same year dem go update that history book.
🆕 Victor Osimhen reaches 31 goals for the Super Eagles. pic.twitter.com/K85Zx5AUQk
— 🇳🇬 Super Eagles (@NGSuperEagles) November 13, 2025
My people, Super Eagles matter don dey sweet again oh!— but make we dey watch sha!
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on November 14, 2025 12:19 pm by Hitvibz Media



Stay connected