Na big joy Zipporah Agama carry come for Liga Femenina as di young Nigerian striker don sign fresh contract wey go carry Levante reach new level for di 2025/2026 season.

Zipporah Agama don run join Levante for Liga Femenina

For just 20 years old, Zipporah dey ready to scatter Spain with correct football and show wetin Nigerian talent fit do.

Zipporah Agama Don Join Levante With Big Dreams

Zipporah new team don kuku confim say na she be di fifth signing for dia transfer window. Dem believe say di raw Nigerian striker go ginger dia attack wella.

She dey come from FC Famalicão for Portugal where she play nine matches, score three goals, and help di team collect five wins, four draws and only one loss.

Nigerian striker Zipporah Agama don land for Levante

Before she carry her skills go Europe, Zipporah bin dey ball for Edo Queens for Nigeria league wey be NWFL.

  Super Eagles Star Wey Get Most AFCON 2025 Goal Contributions Don Draw €35M Fenerbahce Offer

Di team no kuku waste time to open arm welcome am:

From di club, we dey happy to welcome Zipporah Agama and we dey wish am better success for dis new journey.

New Hopes: Zipporah don Ready to Deliver For Liga F

Zipporah yarn say dis chance mean plenty for her life.

E mean plenty to me because Spain na big football country and to sign for did team na dream wey don come true. Na big opportunity for me dis season.”

Zipporah Agama dey enjoy Levante signing ceremony

She add say she ready to carry better character for field:

  Paulina Ali Don Join Levante: Naija Star Say Di Move Na ‘Dream Wey Come True’ For Am

“I wan get better character and behave well.”

Dis season, Zipporah wan help Spanish team waka front:

My goal na to help di team and e go be better challenge for me. I go give my all like last season, play well with my teammates and when chance show, I go score goals.”

She still send sweet message to Levante fans:

Make una believe for di team and make we believe for ourselves. With una support, we fit go far dis season.”

Levante fans make una sha get ready to see magic oh! Cos di whole of Liga Femenina go feel di heat as Zipporah don land to shake di league.

  Ademola Lookman Don Become Atlético Madrid Player After Europa League Big Show
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 11, 2025 6:43 am by Hitvibz Media