Arsenal fans don fit breathe small relief as dem travel go Portugal go collect narrow 1-0 win against Sporting CP for the first leg of their Champions League quarter-final.
This match no easy at all, and for long time, e be like say the game go end for draw or frustration for the Gunners, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Havertz Bring the Ginger for Stoppage Time for Arsenal
The match start with fire as both teams hit bar within the first 15 minutes, but the goals refuse to enter.
Sporting almost score early through Araujo, but his shot hit di goal post. Arsenal sef try their luck when Noni Madueke corner-kick nearly enter direct, but e hit bar too.
Even Martin Zubimendi think say he don score for second half, but VAR talk say Viktor Gyokeres bin dey offside for the build-up. As the game dey end, David Raya show why he be world-class keeper as he make big saves to stop Sporting from scoring.
Just as everybody think say the match go end 0-0, Kai Havertz, wey come from bench, show em clutch power.
For the 91st minute, Gabriel Martinelli give Havertz correct pass, and the German striker coolly bend the ball enter bottom corner.
This late goal na big blessing for Arsenal especially as dem bin just lose EFL Cup final and commot for FA Cup.
This win sweet well-well because na the first time Arsenal dey win away match for Portugal for knockout stage after six trials.
Raya and Defense Don Set Record
Raya sef deserve MTN recharge card for his five big saves. Aside from the goal, Raya performance na talk-of-the-town as he keep another clean sheet for the Gunners, come win MOTM join am.
This one mean say di Mikel Arteta team don keep 39 first-half clean sheets this season, wey pass any other big team for Europe.
But then, Havertz na the hero wey carry the day.
Now, Arteta and em boys go carry this 1-0 lead go Emirates Stadium next week, hoping to finish the work and reach semi-final.
With their solid defense and never-say-die spirit, the Gunners don show say dem ready for the big stage.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on April 8, 2026 1:18 am by Hitvibz Media



Stay connected