Chelsea manager Enzo Maresca don open mouth talk wetin e dey reason as e go face Paris Saint-Germain or Real Madrid for dis year Club World Cup final.
Di Blues secure dia space with correct 2-0 win wey dem knack Fluminense on Tuesday night, na weytin Hitvibz dey yan be dat.
New boy João Pedro score goal for both half wey help Maresca boys enter dia second final for just one month.
Chelsea Oga Maresca Hail PSG and Real Madrid Before Final
Di Chelsea oga talk say e dey “proud” and e ready for either PSG or Real Madrid for di final afta dem don comot di Brazilians for New York.
For di Italian, to face Europe best teams na di reward wey Chelsea deserve.
Afta di win, Maresca yan DAZN:
“I like di two teams; dem dey play better football. Luis Enrique don spend two seasons there; Xabi just reach but we don dey see how e wan play. We go face better team but we dey proud say we don reach there already.”
E clear say di Club World trophy mean plenty for di Blues. Na di first edition wey get di best teams for di world and Maresca sabi say Chelsea need bring dia A game.
Club World Cup Final Chance Dey Make Maresca Proud
As e dey talk about how far em team don go, di Chelsea oga still yan:
“We dey very happy. We dey very proud say we go play di final for Sunday. Na di first edition of di Club World Cup wey get di best teams and we don reach final. Na big achievement.”
Whether na PSG fine football or Madrid European stubbornness, di Club World Cup Final go sure give drama.
Now, Maresca Chelsea go try carry di trophy for Sunday — proud, ready and gatz no fear!
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on July 9, 2025 8:17 am by Hitvibz Media




Stay connected