Naija striker Emeka Eze no waste time show say him sabi ball, as e don fire him first goal for him new club Corum FK.

Emeka Eze Don score em first goal for Corum FK against Adana Demirspor

The goal land inside their 3-0 waya wey dem give Adana Demirspor for their backyard on Saturday evening, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Emeka Eze Knack First Goal and Early Impact for Turkey

Dia match na for TFF 1. Lig Round 2, and Corum no even gree play like away team for Yeni Adana Stadyumu. Dem just scatter everywhere.

Nigerian striker Emeka Eze Dey in action for Corum FK

Bros no even do pass. Just 37 minutes, Emeka Eze don burst net with left leg shot wey land for middle post. Na Yusuf Erdogan package the assist give am.

The 28-year-old baller don already get two goal contributions inside him first two games.

  Christian Nwachukwu Tear Net as Raymond Adeola Shine for Serikspor Big Win vs Adana Demirspor

First match, e dish one correct assist as Corum knack Amed Sportif 2-0. Now na goal. Guy dey collect stat back-to-back like say na free promo.

After Eze don open the floor, na that same Yusuf Erdogan double the yawa seven minutes later.

Emeka Eze Don Hit the Ground Running as Corum FK Crush Demirspor in Flying Start

Before halftime, Demirspor don dey look themselves like “who send us come?”.

  Emeka Eze and Francis Ezeh show clubs pepper as Nigerian players abroad scatter net with goals

Second half, Corum still dey hot. For 78th minute, Atakan Akkaynak nail the final coffin. 3-0, game over.

Demirspor no even see road again. The Red Lightning just dey shine anyhow.

Wetin Dey Next for Emeka Eze and Corum?

As e be now, Corum dey high on confidence, momentum don carry dem. Next stop na Sariyer, and dem dey ready to run am again.

Corum FK dey celebrate 3-0 victory over Adana Demirspor in TFF First League

For Emeka Eze, this fast start don already make am one of the players wey everybody go dey watch this season for Turkey TFF First League.

If e continue like this, defenders go dey see am for dream.

  Emeka Eze knack 12th goal contribution make Sarıyer bail demsef against 10-man Amed Sportif
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 17, 2025 7:51 am by Hitvibz Media