Naija midfielder Jennifer Echegini show herself big time on Saturday, as she score heavy goal take ginger Paris Saint-Germain win Fleury-Mérogis for the French women’s league.

Super Falcons midfielder Jennifer Echegini winning Player of the Match

Even though the goal enter late, na him open floor for PSG as dem wire the home team 2–0 for Essonne Stadium, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Jennifer Echegini shine as PSG pick vital win

For this Première Ligue Round 21 match, the Super Falcons star don carry her total contribution for this season reach ten—six goals and four assists for inside all competitions.

  Jennifer Echegini Shoe Shine When PSG Need Am Pass as Dem Grind Win Against Marseille

Her hand dey everywhere: she don get three goals and four assists for Première Ligue Féminine, one goal for UEFA Women’s Champions League, and two for Coupe de France.

Jennifer Echegini celebrating her goal for PSG against Fleury 91

The Naija babe play full 90 minutes before Ornella Graziani come replace am for dying minute, but she don already finish work for pitch.

The 25-year-old midfielder no just score goal, she still carry Player of the Match award join body for the better ball wey she play.

Echegini goal break the deadlock

As Echegini dey enjoy her levels, another Naija sister, Rasheedat Ajibade, also feature for the match. She enter when 17 minutes remain to replace Romée Leuchter.

  Edna Imade matter don hot pass Cameroon Pepper — Naija and Spain don dey drag her neck

The game bin tight well-well as the two teams struggle to score, but Echegini show face for 80th minute wit better finish to give PSG the lead.

PSG women's team celebrating a 2-0 victory in the French league

Just two minutes after, Sakina Karchaoui double the wahala, as she score the second goal wey seal the three points for the away team.

Even though dem win, Echegini and her teammates still dey third position wit 44 points, as dem still dey trail Olympique Lyonnais wey carry gap of 12 points for top of the league.

  'Proud' Ex-Super Falcons Skippa Dey Hail Her Perfect Successor: Call am "Same Spirit"
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on April 26, 2026 7:57 am by Hitvibz Media