Many Nigerians bin dey wonder weytin dey sup as Super Falcons dey just struggle anyhowbto break ordinary Botswana defence for WAFCON 2024.
Na Chinwendu Ihezuo late goal come finally save dem as she knack one sweet goal wey clear road for quarterfinals, na weytin Hitvibz yan be dat.
Chinwendu Ihezuo Na Real Super Falcons Saviour
After dem play tough match for Casablanca, Falcons manage squeeze past The Mares 1-0.
Halftime come balance 0-0, but Nigeria push harder as match dey hot. But dia opponent defence dey stubborn like rock, block every attack wey come their side.
Time dey finish, tension dey high, na so Ihezuo waka enter, bang one sweet goal for 88th minute as she connect to Esther Okoronkwo pass.
That goal na pure magic wey give Nigeria three better points and keep WAFCON 2024 dream alive.
Falcons Must Step Up For Next WAFCON 2024 Test
Now wey The Mares don commot, Naija babes go need double dia energy for quarterfinals.
Ihezuo show say she get fire, but the whole team must ginger body more if dem wan carry trophy come back.
The Mares wahala show say no match dey easy again for this WAFCON 2024.
Fans dey expect more goals, more vibes and more late-minute magic when e go really matter.
Na who you think go save Falcons next?
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on July 10, 2025 11:09 pm by Hitvibz Media



Stay connected