If you think say Moses Usor and Samuel Adeniran try for dem first two games, wait make you see wetin dem do this time around.

Moses Usor and Samuel Adeniran LASK 4-1 Ried

The two Naija boys bad finish! Dem help LASK turn early goal to heavy 4-1 comeback win against SV Ried inside Raiffeisen Arena, make LASK keep dem 100% record for Austrian Bundesliga season, na weytin Hitvibz dey yan be dat.

Moses Usor, Samuel Adeniran Lead LASK’s Crazy Comeback

Ried shock the home fans after just nine minutes when Niama Sissoko score from Stefan Schwab assist to put away team ahead.

But the reply from the Black-and-Whites sharp die. Just one minute later, Adeniran show for right place at the right time, score from Moses Usor assist to equalize 1-1.

And dat one na just early morning soup.

Seven minutes later, Usor complete the turn-around by imself. Andrés Andrade give am pass, and the Naija forward chop goal for 18th minute to make LASK lead 2-1.

The home team come take total control, and Adeniran neva finish at all.

  Moses Usor help 9-man LASK draw as Hilary Gong continue him goal-scoring form for Trnava

Moses Usor scores for LASK against SV Ried

The 27-year-old striker strike again for 27th minute, score im second goal of the day to make LASK lead 3-1 before halftime whistle blow.

Just look dem numbers.

Adeniran drop two goals and one assist, while Usor drop one goal and two assists. The two of dem directly involve for all the three goals dem score for first half.

Usor and Adeniran Still Dey Run the Show

The two Naija boys continue to pepper Ried defense for second half before dem sub dem out. Adeniran comot for Christoph Lang for 55th minute, while Usor comot eight minutes after.

Even after dem comot, the damage don already set. Lang add LASK fourth goal for 58th minute, to wrap up the correct comeback match wey the two Naija boys start.

Tins come small hard when Robert Ljubicic collect straight red card for 74th minute, make LASK finish the match with ten men.

  Promise Meliga wire Kristiansund go victory as Naija boys show level for different leagues

However, since dem don already gap Ried with three goals, the home side just pack dem bus control the game till final whistle blow.

For Usor, dis match bring im total to two goals and two assists inside three league matches.

On the order hand, Adeniran don fire im total to four goals and one assist inside the same number of games.

E mean say the American-born Naija guy don score four goals inside three Bundesliga games, after e start the season with two goals against Grazer AK and another goal plus assist against Austria Wien.

Naija blood dey the other team too.

Samuel Chukwudi, the defender wey dem born for Faroe Islands but na Naija blood, play for Ried, but the young guy no fit block the heavy flogging dem team chop.

Nigerian stars Moses Usor Samuel Adeniran in action for LASK

For LASK, dis win continue dem fine run as dem dey defend dem title. The champions start with 3-0 win against Grazer AK, chop Austria Wien 2-0 for away, and now dem don flog Ried 4-1.

  Moses Usor and Samuel Adeniran Lead LASK Win Historic Austrian Double After 61 Years

Three games. Three wins. Dem score nine goals, chop only one.

With Moses Usor and Samuel Adeniran dey fire on all cylinders like dis, the Black-and-Whites don give dem rivals big load to think about.

The match attract 14,507 fans and mark LASK 70th Upper Austria derby win.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 15, 2026 7:18 am by Hitvibz Media