One video of one oga for light sector for Bayelsa don blow for internet. E try explain why many Nigerians dey vex say dem dey pay heavy money for electricity bill, even though dem no dey see the light well.
Reports talk say the man name na Innocent Lord Douglas. He nak story on top why people dey get big bills even if na only one hour light dem see for full month, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Why Nigerians Dey Get High El Bill for Small Light
Douglas talk say the koko of the matter be say: billing no depend on how long light stay, e depend on wetin you use.
Many Nigerians don dey complain tey-tey say light company no dey give dem light, but dem dey always bring “crazy bill” come house.
For one interview, the PHCN official explain say the bill dey jump because of how people dey rush use light once e show. When light finally come after long time, everybody dey try do “catch-up.”
“Well, if dem give people light after maybe one week, two weeks, or even one month, and the light stay for only one hour, the people for that area go wan do everything wey dem no fit do for that one month. Dem go on freezer, on washing machine.”
He still talk say this kind rush-rush usage dey make the energy level high like say person use light for many days.
“At the same time, dem go on water pump, on oven, microwave, everything. Dem go even iron all their clothes for one month because dem no know when light go come back. So all these things go happen inside one hour.
The energy wey suppose reach one week, dem don finish am in two hours. When bill come, people go start to dey fight: ‘Why una give me this kind bill?’
But electricity bill no be about how many hours light stay. Na about wetin you use inside the time wey e stay.”
Bill Na for Wetin You Use, No Be for How Long Light Stay
When dem ask am if na time dem dey charge for, di PHCN man clear the air say the matter strictly concern the energy wey you pull from the grid, no matter the time.
“No, e no be how long light stay. Light fit stay for one week if you no dey house, and your bill no go move. Your meter no go blink because you no use am.
But light fit stay for only one hour, and you go use energy wey another person no go use for one week. So the matter na usage, and we dey beg make people understand this one so dem go dey pay when we bring bill.”
Interviewer: “People complain you didn’t give them electricity, suddenly you people will only provide 1 hour of electricity for them. How does that work?"
NEPA official in Bayelsa State: “The way the people use the light is the problem. Once they see light, they will turn on… pic.twitter.com/Ua17gyghOD
— YabaLeftOnline (@yabaleftonline) April 29, 2026
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on April 30, 2026 10:14 am by Hitvibz Media


Stay connected