Dis Super Eagles baller no dey rest oh! Em don run am again — Tolu Arokodare knack two goals wey make big European clubs dey eye, make em come help dia attack next season.
For one preseason match wey tear net reach six goals, Arokodare knack two inside net wey help KRC Genk flog Hannover 4-2, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Tolu Arokodare knack two goals make Genk turn game around
Last season, Arokodare dey burst everywhere, e knack 21 goals plus five assists inside 40 matches — fans still dey hail am.
This time, e still dey hot. E waka enter the match from bench, still run two goals help dem turn 2-0 loss to win.
Oh Hyeon-gyu start the matter, e rush loose ball, fire am go bottom left — score one back.
Mujaid Saduckl level am 2-2 after Hannover no too clear corner wey no pure well
Big clubs dey watch as Tolu Arokodare knack two goals
Arokodare still run levels for dying minutes — e sneak enter box, tap one low cross give Genk lead for 95th minute.
Em no fear, say make em stop there, e still nod another goal with correct header for 112th minute take secure the win for em team.
The Naija striker wey be last season top scorer for Belgian League don show say e ready for bigger show dis time.around.
Victory in the books against Hannover 96 🔥 Goals by Oh, Sadick, and Tolu (2) 🙌 #mijnploeg pic.twitter.com/xJ65ctBeRs
— KRC Genk (@KRCGenkofficial) July 11, 2025
Big names for football like Man United, Dortmund, Bayern, AC Milan dey reason my guy matter this summer.
But for now, Arokodare and him guys go just focus on dia next preseason match against Rayo Vallecano next Saturday.
How you see am?
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on July 12, 2025 7:40 am by Hitvibz Media



Stay connected