Super Eagles banger, Victor Osimhen, dey on fire this season, as e knack two solid assists make Galatasaray waka pass Eyupspor 5-1 for their Turkish Super Lig match last Friday night.

Victor Osimhen assists against Eyupspor in Super Lig

Osimhen na the main guy wey set up di first goal and di third one, as Galatasaray coolly collect 5-star win for their Round 22 clash for RAMS Park, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Victor Osimhen dey Set Early Goals for Galatasaray

Di Naija striker don knack im third assist this season, make im total goal contributions reach 12 in 15 Super Lig matches.

  Victor Osimhen, Paul Onuachu and Ryan Alebiosu: Better news and small tension for Super Eagles stars

E no even reach two minutes as Osimhen knack better ball wey land Yunus Akgün, wey carry head kick am enter di goal for di opener.

Three minutes later, Mauro Icardi knack rebound sharp-sharp inside box, hammer am for top net, make Galatasaray double lead.

Five minutes after dat, di visitors wahala scatter as dem lose one player. Bedirhan Ozyurt carry foul come get red card.

Galatasaray dominates Turkish Super Lig with Victor Osimhen

Two minutes later, Osimhen almost make am 3-0 with head, but e ball waka pass bar.

Galatasaray carry 2-0 go break. After restart, Osimhen knack second assist straight, give Icardi easy chance, and e slide am low make e 3-0.

  Nathan Tella steal show for Bundesliga as em Goal and assist help Bayer Leverkusen wire RB Leipzig

Icardi Hat-Trick + Osimhen Magic Seal Galatasaray Win

For 70th minute, Icardi finish him hat-trick, Baris Yilmaz tee am up, Icardi calm finish for bottom left.

Eyupspor still try, dem score one quick. Metehan Altunbas tap am close-range after rebound drop.

Osimhen think say e score fifth, but assistant flag raise, VAR confirm offside—goal cancel.

Victor Osimhen celebrates Galatasaray 5-1 win

No wahala, di Lions push continue, Jerome Onguene mistake deflect ball enter him own net, seal 5-1 blowout.

Even though Osimhen no score, e run tins well, dey show pesin power for di 6-goal thriller.

Dis win make dem dey top table, dey build confidence before Champions League clash with Juventus next Tuesday.

  Igoh Ogbu and Akinsola ginger dia teams win as Naija ballers for Europe fire goals and assists
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on February 13, 2026 8:30 pm by Hitvibz Media