Besiktas don confirm say their Nigerian star, Wilfred Ndidi, don pick up hamstring injury after the check-up wey medical pipo do for am.
Di Super Eagles captain no fit finish di derby match against Fenerbahçe SK on Sunday, April 5. E commot for field for 85th minute because him de feel pain and discomfort for him hamstring area, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Wilfred Ndidi Medical Report and Wetin Doctors Talk
After dem carry am go Acıbadem Altunizade Hospital go do MRI scan, di result show say di muscle wey dem dey call biceps femoris don tear small and blood de comout inside.
Besiktas release official statement say their medical team don already start to treat Ndidi sharply make e for fit heal.
For di full statement, dem talk say:
“Our football player, Wilfred Ndidi, no fit continue to play for the 85th minute inside our A Team Trendyol Super League match against Fenerbahçe because of pain for him hamstring. Him come do MRI scan for Acıbadem Altunizade Hospital.
The scan show say e get strain and bleeding for the muscle area (biceps femoris). Our medical team don already start the treatment for Wilfred Ndidi.”
Yellow Card Wahala and Next Match
Fenerbahçe win di derby 1-0 after Kerem Aktürkoğlu score one penalty wey cause argument for inside added time for second half.
Apart from di injury, Ndidi collect him fourth yellow card for di season for 52nd minute. This one mean say even if him body set, e no go fit play di next match against Antalyaspor.
Before this Fenerbahçe match, di former Leicester City star don already collect yellow cards for matches against Eyupspor, Kocaelispor, and Kasimpasa.
Since Ndidi join di Black Eagles last summer, him don play 26 matches for Super Lig, UECL qualifiers, and Turkish Cup, and him don score two goals join.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on April 8, 2026 5:11 am by Hitvibz Media



Stay connected