Ademola Lookman don already make big splash for Atlético Madrid, as e score one goal plus give one assist for the team 5–0 bashing wey dem give Real Betis for Copa del Rey quarter-final.

Ademola Lookman scores in Copa del Rey quarter-final

The Naija forward debut no just help Atlético knack big win, e still make him new teammates plus coach Diego Simeone dey praise am well-well, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Ademola Lookman dey shine for Atletico debut

Lookman wey join Atlético Madrid from Atalanta during the winter transfer window no waste time.

The Super Eagles player sharp-sharp show say the club no waste money on am.

Him score Atlético third goal and set up the fourth, guide dem to solid win for Estadio de La Cartuja and secure place for semi-finals.

  Super Eagles baller Nathan Tella don burst net as Leverkusen scatter Frankfurt for Bundesliga

The 28-year-old goal na clean finish on counter-attack, and e still mark 100th goal for him professional career.

Diego Simeone applauds Ademola Lookman after Copa del Rey win

Later, him show say e sabi play and vision well, as e pass correct ball to Antoine Griezmann wey score Atlético fourth goal sharply.

Lookman play 79 minutes before Thiago Almada commot, and four minutes later Almada finish the 5–0 complete rout.

Lookman yan about early days for Atletico

After him debut, the Naija international talk how e dey happy as everything dey smooth for him new team.

Very proud, very happy for my debut, especially for the performance of the team. The team, everyone in the dressing room welcomed me in a very affectionate way. They made it easy for me.

That’s why I’m very happy. I’ll try to be regular in the season. Everyone works hard. There are things that can be improved, but my intention is to continue working to improve, which is the important thing,” Lookman talk as Football Espana quote am.

Super Eagles star Ademola Lookman shines for Atlético Madrid in Copa del Rey_

The forward finishing skills, vision, plus creativity don give Atlético better depth and e dey obvious say people go dey watch am well as the season continue.

  Tochukwu Nnadi don land for Marseille after AFCON shine, Jimoh-Aloba return to West Brom

With this kind strong start, Ademola Lookman don show say e fit dey key player for Atlético Madrid attack and e fit deliver big contributions when the team need am most.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on February 6, 2026 6:38 am by Hitvibz Media