Victor Osimhen don show him big-game DNA again for Istanbul, as the Super Eagles hitman score the equaliser wey ginger Galatasaray comeback 3–1 win over Goztepe.
The victory don stretch their unbeaten Super Lig run reach seven matches. Omo, fire dey this team, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Victor Osimhen strike again as comeback start
The Round 10 clash for RAMS Park start with early gbege as Efkan Bekiroglu tap in rebound inside six minutes to put Goztepe ahead. VAR come enter the chat, review long review, but goal still stand.
Galatasaray players con para small minutes later as dem shout for penalty when Osimhen kpai enter box and land for ground. VAR look am again, ref still bone face — play continue.
Osimhen vex. Just two minutes after that denied penalty, the guy scatter defence — dribble one, dribble two, shift keeper with small cruise dummy, then slot equaliser wey sweet like cold Orijin. VAR check am again, this time dem gree: GOAL!
VAR drama, red card wahala and full takeover
Goztepe life spoil pass like that as Malcom Bokele collect second yellow before halftime. Visitors reduce to 10 men, pressure don hook dem.
Early second half, Osimhen nearly bag brace but keeper pull mad save. The momentum don shift finish.
Galatasaray finally complete the comeback — Gabriel Sara lash home 2–1, then Mauro Icardi, Mr. Sniffer of Rebounds, finish the matter 3–1 inside box.
Osimhen still nod one dangerous header later but keeper stop am. Still, everybody know who run the show.
Osimhen form dey catch fire
The Nigerian don now score back-to-back for Galatasaray and don contribute 10 goals this season for club and country.
Baba play 86 minutes before coach comot am — three Super Lig goals, three Champions League goals in nine appearances. No be beans.
Galatasaray still dey top table with six-point gap as dem face second-placed Trabzonspor next — Osimhen vs Paul Onuachu dey load. After that, Champions League wahala vs Ajax. Everywhere go burst.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on October 26, 2025 6:45 pm by Hitvibz Media




Be the first to comment on "Victor Osimhen chop goal number 6 as Galatasaray stretch unbeaten run reach seven"