Naija baller Chuba Akpom, show say em still get class for the final game of Ligue 1 season as e knack one late goal against Reims wey help Lille manage collect 2-1 win for their home ground, Stade Pierre-Mauroy, on Saturday evening.
The 29-year-old striker no waste time show impact as e enter the match for 73rd minute come replace Jonathan David, Hitvibz reports.
As the match dey 1-1, Chuba Akpom come prove say e get strong mind as e win one late penalty and sharply score am, give Lille the winning goal.
Na him only shot for the match—and e make am count well.
Em goal against Reims show say Akpom no dey joke
Even though say Akpom play just 17 minutes, the guy still manage score him third Ligue 1 goal of the season. Since e land Lille from Ajax on loan, e don get three goals and one assist inside 14 league games.
Akpom just dey calm under pressure and him sabi run smart, na why Lille collect the three points—even though dem no still reach top four for table.
The match get plenty meaning for di two teams sha. Lille dey pursue Champions League spot like say dem wan buy gala while Reims dey fight make dem no drop enter relegation.
After small drag-drag start, na Rémy Cabella kuku break the deadlock with one wicked back-heel volley just before halftime.
Reims no gree as Sergio Akieme tear net with em own heavy volley wey bounce under the bar enter net come balance the game.
Lille come fire harder, and na Joseph Okumu wey come do gbege for box as e push Chuba Akpom. The naija boy just coolly send Diouf go one side and score the penalty to make am 2-1.
Akpom goal no fit save am from exit
Even with all em gra gra, Chuba Akpom no go dey with Lille again next season. The club sharply drop list of players wey go comot after the game, and Akpom name dey among.
Others wey follow comot include Jonathan David, Angel Gomes, Remy Cabella, Mitchell Bakker, and Samuel Umtiti.
People bin dey reason say Akpom fit replace Jonathan David as e don dey get more play time lately. But Lille don clear doubt say dem no go keep am.
That goal against Reims fit be Akpom last one for Lille shirt, but e don surely leave better memory.
Be the first to comment on "Chuba Akpom ticket don cut as em score winner for Lille—but dem still pursue am from Ligue 1"