Super Falcons midfield machine, Deborah Abiodun, don finally open her goal-scoring account for Washington Spirit as she knack one sweet goal wey help dem flog Vancouver Rise FC Academy for Concacaf Women’s Champions Cup.
The Naija pikin no even start match—she waka come from bench come scatter ground, fire the fourth goal wey confirm say Washington Spirit no dey joke. Dem hammer Vancouver Rise FC 4-0 for Audi Field, na weytin hitvibz yan be dat
Washington Spirit No Gree Pity Dem
My guy, this Spirit team na real wahala! Dem no even gree show small pity for Vancouver babes wey just land. Deborah play only 45 minutes, but omo, she worry goalkeeper with three hot shots, one enter net sharp-sharp.
Make we no forget, this same Spirit don open their Champions Cup campaign with 7-0 demolition wey resemble training ground exercise against Alianza Women FC. Dem just dey use teams do practical.
First blood drop for 31st minute—Tara McKeown see space outside 18, gbam! Long-range missile enter, keeper just dey look like cinema spectator.
Ten minutes later, Heather Stainbrook rise like CR7, nod Courtney Brown cross enter bottom left. Keeper just dey pick ball like pepper for market.
Before half-time, Trinity Rodman say “make I add my own.” Simple cross from Paige Metayer, boom! Third goal. Na real baptism of fire.
Na Deborah Abiodun Finish Di Show
Second half start, coach bring in our Naija midfield engine, Deborah Abiodun. Na her second game since dem recall am from loan. Omo, she no waste time show say she dey hungry for goals.
81st minute come, Deborah line one bullet from outside box. First try, keeper manage catch. Second try? Forget it! Deflection help am, ball fly enter top corner. Croix Bethune sabi herself, she package the assist well.
Washington Spirit dey show muscle everywhere—bench strong, attackers dey scatter defenders like suya pepper. Meanwhile, Vancouver Rise babes just dey run upandan like Nigerians when NEPA light show.
Wetin Dey Next?
After this hammering, Abiodun and her Spirit team go shift attention back to NWSL, where Seattle Reign FC dey wait dem on Sunday, September 7.
If dem continue with this ginger, e go hard for anybody to stop dem unbeaten cruise.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on September 4, 2025 8:36 am by Hitvibz Media




Stay connected