Boys wey dey Port Harcourt no wan dull this season. Rivers United don sign fresh baller – Wisdom Samuel, sharp winger wey believe say na correct club e don join to blow.
Last season na relegation wahala with Heartland nearly run am street, but Samuel talk say na new chapter don open. Him target dey clear like daylight – help Pride of Rivers carry league plus shake body for CAF stage, na weytin hitvibz yan be dat
Baba don already join two training with the squad before their Matchday 3 clash with El Kanemi Warriors for Maiduguri this Sunday. Na for Footballrover side e drop all the gist.
“Rivers United Na Big Team, I Wan Win Everything”
When dem ask am why e choose Rivers United, Samuel no even reason am twice.
E just yarn:
“Rivers United na big team, who go see chance play here and reject? I wan achieve everything – score goals, lift league, plus continental glory. Everything dey possible.”
You see am? The boy mouth sweet, ambition dey fire.
Lesson Wey Relegation Teach Am for Heartland
As e look back him Heartland days, Samuel talk say relegation no be beans. E teach am lesson wey e no go forget.
“Anytime chance show, grab points for away. Na very important.”
Now that ginger dey fuel him hustle for United – goals, assists, anything wey go make Port Harcourt fans dey hail am.
First Touch for PH City
Since e land for PH, Samuel dey feel at home.
“Na big club, and I dey happy. Coaches and players welcome me well. I dey enjoy am,” na so e yarn.
Bros dey settle down fast, e don already dey enter the groove.
Ready to Deliver as Winger
Rivers United dey chase league plus CAF shine. Samuel sabi wetin dem expect from am.
“I go do wetin wingers dey do, by God’s grace – score goals, give assists. For this league, na goals dey talk pass.”
Abeg, the guy dey talk like pesin wey wan turn defenders to cone.
Pressure No Dey Fear Am
Pressure? For Samuel mind, na small matter.
“If you dey ready, pressure no dey kill. Na motivation be that. I go turn am to fuel carry Rivers United go far.”
You dey hear? Guy don get strong mentality.
Where em Journey For Football Start
From Sporting Lagos to Giant Brillars for 2023/24 season, Samuel don waka small.
Later na Heartland, where e play 22 NPFL matches, 1,115 minutes, and bag only three goals.
But even though Heartland waka go relegation, this Rivers United move na like clean slate for am – time to set eye for bigger things.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on September 4, 2025 11:14 am by Hitvibz Media





Stay connected