Defender Evans Ogbonda don officially comot for Nigeria Premier Football League side Enugu Rangers as em don secure move go Zambia giants Power Dynamos, one of Rivers United CAF Champions League rivals, as dem dey prepare for serious continental battle.

Evans Ogbonda in action for Enugu Rangers

The Port Harcourt-born left-back Evans Ogbonda na one of Rangers best players dis season, and e don decide say na time to try football outside Nigeria, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Evans Ogbonda don comot Rangers join Power Dynamos

The Coal City team confirm say dem don complete permanent transfer of Ogbonda to Dynamos, while Rangers go still collect 40 percent if dem sell am again in future.

  "I get big things" — Rivers United baller Iyowuna Douglas talk as e enjoy two assists vs Insurance

Rangers talk say the move na big step for Ogbonda career and dem proud say e dey go join one of Southern Africa most respected clubs.

Evans Ogbonda unveiled by Power Dynamos in Zambia

Dem also thank am for the discipline and commitment wey e show during im stay for Enugu.

Ogbonda carry NPFL and CAF experience enter Zambia

At just 23, Ogbonda dey land Zambia with strong experience from Nigeria top clubs and CAF competitions.

E start him senior football waka for Ifeanyi Ubah wey don fold for 2020/21 season, come move go Akwa United for 2021/22, before e show for Bendel Insurance for 2023/24.

  Kun Khalifat coach still chest out talk say “we dey on track” after Rivers United wire dem 4-2

Em last spell with Flying Antelopes for 2024/25 season help polish em game well well, and im experience for CAF Champions League and CAF Confederation Cup make am valuable signing for Dynamos.

For Zambia, e go team up with former Shooting Stars defender Ayodeji Bamidele as dem dey push for better run for 2025/26 season.

Evans Ogbonda joins Rivers United CAF rivals

Dynamos recently play goalless draw with Rivers United for CAF Champions League, and both teams go meet again this Sunday for Godswill Akpabio International Stadium, Uyo.

Hitvibz gather say Ogbonda go waka join him new team for Uyo make dem finalize the transfer.

  NPFL: Finidi George push Rivers United carry double record glory after dem beat Barau FC
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on January 28, 2026 7:58 am by Hitvibz Media