If you dey play Football Manager, you go sabi the guy well-well. Elijah Akanni, the NPFL golden boy for the game, don carry him bag comot from Enyimba FC.
And no be only him waka go o – the club clear house like say them say dem.dey try pursue rat comot their.compound, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Dem don release 22 senior players few days before league go start. Abeg who dey run this club like PES career mode?
Football Manager Star Say Bye-Bye to Enyimba
If you dey FM24, you sabi say Elijah Akanni no be anyhow baller. For game, dem price am £202k, but if you wan sign am, you go cough £231k.
Omo! Na transfer budget wey fit make small European club dey reason loan moves.
The guy born 22 August 2001 – meaning say for start of the game him still dey fresh 23 years, 10 months plus change.
Him dey earn just £180 per week for Enyimba. That one na like weekly bread and beans money for Naija streets, but for game e still dey ball.
Ability rating? 2/5 for now, but potential na premium package. If na FM, you go just dey look am like “omo this one fit turn NPFL De Bruyne.”
As reality knack, bros shock everybody with him exit. E even write emotional epistle for X (formerly Twitter).
Him thank chairman, teammates, fans… the full “it’s not you, it’s me” break-up vibes. Bros almost sound like person wey dey dump babe gently.
Enyimba Clear Bench – 22 Players Out!
No be small tin. Enyimba don scatter squad like team wey dem relegated. 21 other players join Akanni for exit door.
Names like Brown Ideye, Ani Ozoemenam, Musa Babalola, Innocent Gabriel, Fatai Abdulahi – bros dem no dey Enyimba again.
Some others like Umeh Gozie, Alade Balogun, Imo Ikemdinachi, Leonard Obinna follow waka.
The remaining three – Obichere Odinaka, Purpose Ahumaraezemma, Samuel Nuako – no be chop ban, na loan dem carry go.
Club yarn say na “long-term rebuild strategy.” Na the kind grammar wey Arsenal fans sabi. But truth be say, this kain squad wipe-out fit scatter preseason plans.
Wetin Be Di Next Step for Enyimba and Their FM Darling?
Timing mad o. New NPFL season dey start sharp-sharp. First match? Away to Barau FC.
Then dem go chop back-to-back home games against Niger Tornadoes and Nasarawa United.
Akanni own matter? For FM and for life, the boy still dey hot cake. At 23 years, him still get future like Osimhen boot collection. Potential full ground – e fit blow pass NPFL level soon.
But the big question be: where the guy go land before season kick off? Or we go soon dey hear “Elijah Akanni don sign for small Scandinavian club” gist wey dey always happen to Naija ballers?
For now, Enyimba fans just dey reason – “Na rebuild abi na relegation loading?”





Be the first to comment on "Football Manager Wonderkid Elijah Akanni Lead 22-Man Japa as Enyimba Press Reset Button"