Rivers United been chop small hope, but in the end, na premium tears follow them go house for their TotalEnergies CAF Champions League Matchday 2 waka for Godswill Akpabio Stadium, Uyo.

Rivers United 1-2 RS Berkane in CAF Champions League

Dem first make belle sweet fans with early lead, but as usual, dia ball na yawa—RS Berkane from Morocco turn the table, beat dem 2-1, na weytin hitvibz yan be dat

Just like that, Pride of Rivers dey bottom of Group A with zero points—like somebody wey forget wallet for bar.

Rivers United Take Early Lead but Fail to Finish Strong

First half be like say United don come with new ginger. Dem even score from corner but referee blow am offside—VAR for don cry that day.

But no wahala, Friday Ubong try one shot wey knack RS Berkane defender Mamadou Lamine Camara, the ball waka like rainbow, lob the keeper enter net.

  Rivers United Oga React to Niger Tornadoes Wahala: "Na Continental Football We Dey Pay For"

Fans shout ehn—stadium shake like person win sports betting. Rivers United don finally get their first-ever CAF Champions League group stage goal, even though na own goal.Rivers United celebrate first CAF Champions League goal at Godswill Akpabio Stadium_

But after that, dem no fit carry the ginger reach full time. The Moroccan champions just dey press like team wey sabi say equalizer sure for pot.

Rivers defence come dey behave like akara—too soft, too open, everybody dey enter.

Late Strikes Deny Rivers United First Points

As match dey finish, United fans don dey package celebration. But football wicked—na why we love am.

Seven minutes enter added time, Youness El Kaabi score equalizer—booom!
Before United fit even adjust socks, one minute later, Mounir Chouair finish dem with the winning goal.

  Rivers United baller Stephen Manyo dey jolly as dem cut Barau FC 7-game no-loss levels: “Body sweet me”

2-1. Quick double. Premium breakfast.
Na the same style heartbreak dem chop last week for Cairo against Pyramids FC—Finidi George boys don dey collect late goals like complimentary snacks.

Takeaways from the Match

– Rivers United still never score official CAF Champions League group stage goal. Na only own goal dem get, like person wey borrow pen for exam.

Rivers United 1-2 RS Berkane

– Defence still dey leak. Five goals conceded in two matches—clean sheet no even near their dictionary.

Looking Ahead

Pride of Rivers go need serious reset. Next continental wahala na Power Dynamos for Zambia when Matchday 3 land January 2026 after AFCON 2025 finish—serious away test.

  Morice Chukwu: Ex-Rivers United baller don yan why e no go ever return to NPFL again

For now, dem go park CAF matter for one side, return NPFL groove as Kano Pillars dey come visit them for domestic clash.

Make dem tighten marking o—because as e be now, ball dey show dem shege.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on November 29, 2025 6:10 am by Hitvibz Media