Super Falcons babe Rofiat Imuran no get the kind debut wey dey sweet for body. Her London City Lionesses waka jam Arsenal Women for WSL season opener — na five-goal drama wey end 4-1, Gunners way!
The 21-year-old fight tire, run scatter field, but Arsenal attack dey like generator wey no dey off. At the end, Lionesses chop four, manage score one—be like people wey dem use hypo wash, na weytin hitvibz yan be dat
Rofiat Imuran Try Sha, But Arsenal Wahala Just Too Much
Di Babe play 89 minutes before dem sub am with Lucia Corrales after small injury wahala.
Before she comot, she still show say she no be learner: three interceptions, nine recoveries, four ground duels win.
She even shake bar with one thunder strike wey nearly tear net, but luck say “no today.” Na so football be. If na beer parlour, we go talk say ball no wan enter by force.
Meanwhile, Arsenal dey do wicked things. Dem just play like people wey APC dash money.
They brush off the Lionesses early shock like “na small pikin dey play.” Goals begin rain before and after halftime. Na statement win.
Arsenal Quick Reply After Lionesses Small Pepper
Lionesses first shock dem o! Kosovare Asllani slot calm penalty for 17th minute after Katie Reid commit one kain wrestling foul inside box. Emirates quiet like NEPA just take light.
But Arsenal no dey carry last. Olivia Smith blast debut rocket from far — goalkeeper just dey pose for picture.
Before halftime whistle, Chloe Kelly drop another one. Arsenal carry 2-1 go break. Na so momentum change sharp-sharp.
Second half? Na pure torture. Arsenal dey press like say dem wan fry puff-puff. Stina Blackstenius score 83rd minute, and before Lionesses fit breathe, Frida Maanum add another. Two goals in one minute — Arsenal just dey whine dem.
Next Stop: Manchester United Wahala
Match wey start with Lionesses ginger end with Arsenal cruise control. Gunners remind everybody say once their attack connect, e be like jazz — nobody fit stop am.
Now, Imuran and her babes go gats clean body sharp-sharp. No time for long face. Next week na Manchester United dey come.
If Arsenal na hurricane, Red Devils na thunderstorm. Imuran go need double energy drink if she wan shine again.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on September 6, 2025 6:18 pm by Hitvibz Media


Be the first to comment on "Rofiat Imuran First WSL Match Shock Am as Arsenal Wash Lionesses with Hypo"