Super Falcons striker, Chiwendu Ihezuo, no gree joke on Friday night. Babe tear net two times, carry woman of the match tag join body, as Pachuca knack Juárez Women comeback 3-2 for their Mexico Liga MX clash.

Chiwendu Ihezuo celebrates Pachuca women goal vs Juárez women

Na she equalise, na she still score winner. One-woman demolition squad wey spoil Juárez party for Estadio Olimpico Benito Juárez, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Chiwendu Ihezuo show: from Juárez joy to Pachuca palava

Babe dey fire! That brace don push am to five goals in just five appearances this season. Five for five—omo, na hot streak wey dey pepper defenders.

Pachuca women star Chiwendu Ihezuo scores brace in Liga MX

The match? Omo, na proper telenovela script. Juárez open scoring early through Dayana Martins—just 10 minutes, boom! Home fans don dey scatter ground.

But Pachuca no gree. Five minutes later, American-born Naija pikin Ayooluwa Oke balance am 1-1. Na so game turn to who-get-power pass.

  Vivian Ikechukwu tear net with correct goal as Santos Laguna fall yakata for Necaxa hand

27th minute, Juárez veteran Liliana Mercado show say old soldier still sabi ball. She make am 2-1, Juárez fans dey shout say “today na our day!”

But dem no know say Ihezuo don tie headscarf for war. 31st minute, she level am again.

Juárez women vs Pachuca women Liga MX Femenil action

Then on top first-half whistle, she coolly slot another one—brace complete. Juárez fans quiet like mortuary, Pachuca dey dance.

Juárez shine small, but Ihezuo scatter the script

Ihezuo double wahala just flip the whole game upside down. Halftime come, Pachuca dey lead, Juárez dey confuse.

  Vivian Ikechukwu tear net with correct goal as Santos Laguna fall yakata for Necaxa hand

Second half start, another Super Falcons face enter the movie—Osinachi Ohale replace Andrea Pereira.

Babe carry bouncer vibes enter defence, block anything wey try waka near goalpost.

From there, Pachuca just manage game like person wey dey guard suya. No rush, no panic, just dey grind result jeje.

The match get everything—early goals, quick replies, veteran show, and Naija girls wey scatter pitch with vibes.

Chiwendu Ihezuo leads Pachuca women comeback win

Final Score: Juárez 2-3 Pachuca Women

Goals: Martins (10’), Oke (15’), Mercado (27’), Ihezuo (31’, 45’)

Na correct away win wey lift Pachuca to second for table with 23 points. Just one point dey between dem and table-topper Club América Women.

  Chiwendu Ihezuo Scatter Net Again as Pachuca Run Chorrillo Street for Concacaf Cup

Na so Ihezuo and co dey use small-small pepper dey cook title chase.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on September 6, 2025 9:31 am by Hitvibz Media