Just three days after she scatter defence with fine hat-trick carry Al Hilal enter semi-final of Saudi Women’s Challenge Cup, Super Falcons queen Asisat Oshoala no even allow grass grow.

Asisat Oshoala celebrates goal for Al Hilal in Saudi Women’s Challenge Cup

Wednesday night, she come again, deliver fresh football lecture for night match, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Na the same Oshoala still dey control everything as Al Hilal burst Al Ahly bubble with heavy 6–2 win, waka enter final with authority.

Another hat-trick land, defence don tear like old net. Beer parlour shout everywhere.

Asisat Oshoala Lead Charge as Al Hilal Scatter Al Ahly

Asisat Oshoala scores as Al Hilal beat Al Ahly 6-2

From early whistle, Oshoala talk say “make una relax.” She open scoring sharp-sharp, set the tempo, help Al Hilal go break time with calm 2–0 lead. No panic, just cruise control.

  Super Falcons star Esther Okoronkwo don collect Player of the Match afta dem knack Tunisia

Second half resume, Jessica Silva add the third like say na training ground. Before anybody fit shout “mark am!”, Oshoala don strike again — 4–0, match don almost finish for mind.

Silva no carry last, she complete her own brace make am five. Then Oshoala lock everything with her third goal of the night — another hat-trick, back-to-back. Referee self fit smile.

Asisat Oshoala celebrates second hat-trick Al Hilal in Saudi Women’s Challenge Cup

Al Ahly try manage pull two goals back, but na late story. Damage don already happen. Al Hilal just dey pass ball dey enjoy life till final whistle.

  Esther Okoronkwo: Super Falcons star yan wetin really dey important afta dem win Tunisia

Saudi Women’s Challenge Cup Final Don Call Oshoala Name

Six-time African Women’s Player of the Year no dey slow down at all. With this performance, Oshoala season goals don reach 12 across all competitions, six of them na inside this same Saudi Women’s Challenge Cup.

She still get two assists for Saudi Women’s Premier League, carry her total goal contributions reach 14. If you ask coach José Ángel Herrera, na Oshoala be engine wey dey push this team.

Asisat Oshoala net hat-trick against for Al Hilal in Saudi Women’s Challenge Cup

Next stop: big final clash against Al Nassr. All eyes go dey on Oshoala again, because if ball need decide, everybody know who fit talk last.

  Super-sub Joy Omewa tear net again — 21 goals as Fortuna knack better comeback vs Koge
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on December 17, 2025 10:52 pm by Hitvibz Media