Hitvibz follow plenty Super Eagles and Super Falcons players this weekend, and na Victor Osimhen lead the whole parade with him hot performance.

Paul Onuachu and teammates

Raphael Onyedika sef show steady levels, plus other Naija ballers wey drop correct contributions for their clubs, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Victor Osimhen Burst Net – Fire Galatasaray to Win

Omo, Victor Osimhen no send anybody this weekend. The guy just land for pitch like him wan use AFCON 2025 warm-up finish. Galatasaray knack Samsunspor 3–2, and na Osimhen collect microphone.

victor Osimhen leads Galasataray to victory

First he package one correct finish, later he come burst ground with one late bicycle kick wey get commentators shouting “Kai! Na wetin be this madness?!”

With that, Baba don reach 11 goals for 14 matches this season. Remember say na him first goal since that injury wey he collect for Nigeria World Cup playoff. But as e take play, e be like engine wey dem just service.

Full 90 minutes. Double figures. Galatasaray still dey top table. Champions League dey look them like exam on Monday morning.

Onyedika Open Shop for Brugge – Early Goal, Wahala Still Enter

Raphael Onyedika talk say “una calm down, make I show una something.”
16th minute, boom! First league goal of the season. Club Brugge dey smile small.

Raphael Onyedika strikes early as Kaye Furo nets first senior goal in Club Brugge’s narrow defeat

But Sint-Truidense no gree. Dem knack two quick goals wey turn Brugge to “how did we get here FC.”

Na young blood Kaye Furo wey come from bench come equalize with him first senior goal – sharp boy!

  Fisayo Dele-Bashiru yan 4 correct rules wey dey guide Super Eagles for AFCON: "We go do am well"

But hosts still finish work for 81st minute. 3–2 loss. Brugge carry L go house.

Onuachu Quiet for Front, Turn Correct Defender for Back

Paul Onuachu dey for pitch like gentle giant as Trabzonspor still manage collect 2–1 win over Göztepe.

Anthony Dennis outshines Paul Onuachu as Tochukwu Nnadi stars in Waregem draw

Anthony Dennis from Naija score late goal for Göztepe, but e no reach. Ernest Muci carry Trabzonspor for head with brace.

But gist no end there – red card enter the matter. Trabzonspor come short one man. Who dem go call? Onuachu.

Guy play makeshift centre-back for over 20 minutes like say na him real job.
Brother win duels up and down, clear ball like landlord wey dey pursue tenant.

Defensive stats wey sweet belle:
— 10 clearances
— 13 duels won (highest for pitch)
— 11 defensive contributions
— 1 blocked shot
— 11 headed clearances
— 3 recoveries

Even though e no score, he still maintain top scorer status with 11 league goals.

Lookman Grind 90 Minutes, Orban Chop Bench as Verona Shock Atalanta

Ademola Lookman run full match but Atalanta still collect 3–1 woto-woto for Verona.

Ademola Lookman

Guy try, move around, look dangerous small, but results no gree align.

Gift Orban? Bros still dey struggle for minutes. Verona bench hold am tight like ASUU strike.

Lookman still one of their regulars this season sha, even as transfer talk dey fly. Now all focus don shift to AFCON waka with Super Eagles.

Dele-Bashiru Ginger Lazio for Draw

Fisayo Dele-Bashiru enter the show for 75th minute as Lazio draw 1–1 with Bologna.

  Rangers Title Hope Don Scatter as Cyriel Dessers' Goal No Reach for Old Firm Derby Loss

Fisayo Dele-Bashiru

Lazio don score through Isaksen before Bologna reply sharp sharp via Odgaard.

The match come end like two stubborn goats wey jam for bridge – nobody shift, nobody fall.

Moses Simon Run Work as Paris FC Play Goalless Draw

Moses Simon play him 14th game this season as Paris FC hold Le Havre 0–0.
He don get 3 goals + 2 assists this season already.

Moses Simon

He commot for 66th minute. Paris FC even miss penalty for 79th minute – wahala.

Both teams waka go house with one point each.

Bassey, Iwobi, Chukwueze, Uche Enter Action – But Fulham Still Collect from Crystal Palace

Na full Naija house as Fulham face Palace.

Chukwueze return with ginger after that Man City show.

Christantus Uche

Iwobi and Bassey still steady. Uche enter for Palace during second half.

Fulham first score through Eddie Nketiah, but Palace no gree. Harry Wilson equalize. Then late-late minute, Guehi nod home Pino corner.

Palace waka commot with 2–1 win. Fulham still dey 15th – relegation zone dey look them with side eye.

Oshoala Still On Fire – Al Hilal Win Again

Asisat Oshoala dey cook steady for Saudi league. She score opener again as Al Hilal beat Eastern Flames 2–0.

Al Hilal forward Asisat Oshoala scoring opener

Na her sixth league goal – 8 goal contributions in 7 games. Babe don turn cheat code.

Her goal come for 43rd minute. Al Bandari Mobarak seal am later.
Al Hilal now second with 15 points.

  Ademola Lookman Dey Hot Wella, Score Him First La Liga Goal as Atlético Madrid Scatter Espanyol

Ordega Finally Break Goal Wahala – Al Ittihad Celebrate

Francisca Ordega don vex, break her goal drought with style as Al Ittihad beat Neom SC 2–0.

Francisca Ordega scores first goal of season

Her first start of the season, and she no waste am. Immediate impact. She score first goal, create most chances, and show say last season form never die.

Al Ittihad jump to third. Ordega’s first league goal this season fit just be the spark wey she need.

Toni Payne Scatter Chelsea Plan – Everton Shock Everybody

Toni Payne just turn engine room for Everton as dem beat Chelsea 1–0.

12th minute, she burst right flank, send correct assist to Honoka Hayashi – goal!
That na her second WSL assist this season.

Toni Payne assist Everton win Chelsea

Chelsea pressure wan finish Everton later but Payne and co hold body. Na big result – ending Chelsea’s 585-day unbeaten league run.

Everton collect their first win in eight matches. Toni Payne na the real MVP for the upset.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on December 8, 2025 12:27 pm by Hitvibz Media