Super Eagles forward Salim Fago Lawal perform well well on Tuesday night as e score one fine goal, but the goal no still save NK Istra 1961 from losing against HNK Rijeka for their Round 18 match for Croatian First League.

NK Istra 1961 striker Salim Lawal match action

The Nigerian forward just return join him club after e follow Super Eagles go Morocco, where dem pick bronze medal for AFCON 2025, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Salim Lawal burst ground immediately for NK Istra 1961

Lawal AFCON no too loud for am, as e sit bench for most matches and only enter field for one minute when Nigeria beat Uganda 3–1 for group stage.

  Super Eagles Players Bin Small Pikin for AFCON 2023, Alex Iwobi Talk How Dem Don Glow for 2025

But once e reach club side, e no waste time at all. Na five minutes into the match for Stadion Aldo Drosina, Lawal don don score and announce say e don land.

Super Eagles forward Salim Lawal in Croatian league action

That goal show say e mean business, and e carry him total goal contribution for this season reach 9 — seven goals and two assists.

For 19 matches across all competitions, Lawal don score five goals and record two assists for the league, plus two goals for Croatian Cup.

E don also score for back-to-back matches for Istra, after e close scoring for their heavy 5–1 win against Osijek for the previous game.

  Alex Iwobi Shine Scatter, Chukwueze Two Late Goals Burst Brain for Fulham 9-Goal Wahala Match

Istra 1961 lose late despite Lawal early goal

For the Rijeka match, Lawal play 58 minutes before dem substitute am bring Vinko Rozić. Before e comot, na im give Istra early lead, but Luka Menalo level am four minutes later.

Seventeen minutes after Lawal comot, referee give Rijeka penalty, and Tiago Dantas calmly score am to collect all three points for the visitors.

Salim Lawal celebrates goal vs HNK Rijeka

Even with the loss, Istra still dey fourth position for table with 26 points — just one point behind Rijeka.

After dem suffer their first loss in four matches, Lawal and him teammates go try bounce back when dem travel go face Hajduk Split on Sunday.

  Emmanuel Dennis don leave fufu and egusi, go chop red card sharp-sharp—See how e take put Blackburn for wahala
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on January 20, 2026 7:45 pm by Hitvibz Media