Super Eagles skipper William Troost-Ekong no get better night for Saudi Pro League as him own goal knack Al Kholood 3–2 loss for dia own house against Neom on Thursday evening.

Super Eagles captain William Troost-Ekong reacts after own goal

The thing pain. The guy don turn strong pillar for Al Kholood this season, but that King Abdullah Sport City Stadium wey suppose be him fortress come turn wahala ground, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Troost-Ekong’s Own Goal Burst Al Kholood Groove

Na for 32nd minute e happen. Ekong try clear one deadly pass, but as him leg meet ball, the thing do one funny bounce, waka pass keeper head enter net. Just like that, Neom collect 2–1 lead wey spoil Al Kholood mood.

  Wilfred Ndidi: Wahala for Besiktas as Super Eagles baller Don Carry Injury for Derby match vs Fenerbahçe

From there, the home boys just lose balance. Dem still try push last-last but e no gel — Neom hold dem 3–2. Na Al Kholood fourth loss for seven league games, dem dey sit for 9th position with just nine points.

William Troost-Ekong in Al Kholood match action

Ekong don play seven matches this season, but this one na another tough chapter for him Saudi experience. Bros need small deliverance from football village people o.

Bloemfontein Spirit Still Dey Pursue Troost-Ekong

Na like déjà vu. Remember that World Cup qualifier for Bloemfontein? September 9, when Super Eagles face South Africa? Na Ekong first give Bafana free goal that day before Calvin Bassey save face with header to make am 1–1.

That match later help South Africa grab World Cup ticket, while we still dey drag playoffs. E be like say the Bloemfontein spirit still dey whisper for Ekong ear anytime ball near him post.

  AFCON 2025: Chidozie Awaziem don yarn how Super Eagles fit do the magic against Morocco

Super Eagles Captain Troost-Ekong Endures Another Costly Nightmare in Saudi Pro League

Now wey Al Kholood dey struggle for Saudi and Nigeria get do-or-die playoff with Gabon next month, Ekong go wan reset him head sharp-sharp.

Time don reach for am to show that same ogbonge focus and leadership wey make am Super Eagles captain in the first place.

Football no easy o — but if anybody fit bounce back, na our oga defender. Just make village people no follow am go training again.

  Alex Iwobi Shine Scatter, Chukwueze Two Late Goals Burst Brain for Fulham 9-Goal Wahala Match
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on October 31, 2025 9:26 am by Hitvibz Media