Chiamaka Nnadozie yarn on Super Falcons WAFCON win vs Tunisia: “We dey respect dem”

Chiamaka Nnadozie don react to how Super Falcons take win dia first WAFCON game

Super Falcons don start dia WAFCON journey well well — and Chiamaka Nnadozie no fit hide her joy afta dem nack Tunisia babes on Sunday evening.

Chiamaka Nnadozie don react to Super Falcons dem first WAFCON win

Naija correct goalkeeper happy say Super Falcons start beta against Tunisia, as Asisat Oshoala, Rinsola Babajide, plus Chiwendu Ihezuo wey come from bench, score goals wey show say dem serious for Morocco, na weytin hitvibz dey report be dat.

Chiamaka Nnadozie dey praise Super Falcons afta first WAFCON win

Afta final whistle blow, di former Paris FC goalkeeper yarn wetin dey for Falcons camp:

I dey feel good well well; e sweet me, na good start for we,” she talk.

Super Falcons players after dia first WAFCON win vs Tunisia

Di Falcons don nack Tunisia for di first time for Women’s Africa Cup of Nations, afta dem draw 0-0 for dia first match back for 2008.

  Esther Okoronkwo Carry WAFCON Fire Enter NSL, Scatter Montreal Roses for AFC Toronto Win

Di nine-time African champions don dey make am normal to dey start WAFCON campaign with correct win.

Against North African teams, dem still dey show say dem no dey play — dem win Morocco 8-0 for 1998 and nack Algeria 4-0 for 2004.

“We dey respect dem” – Nnadozie still dey focus afta di win

Even wit di big win, Nnadozie know say work still dey ground.

Chiamaka Nnadozie dey celebrate Super Falcons WAFCON win

Di Tunisian babes no be bad team; we dey respect dem well well. Dem play better ball, but today (Sunday) na we own, and we go like continue like dis,” she talk.

For di new Brighton women keeper, to dey sharp na di koko, even if work no too dey.

  Journey Number 10: How Super Falcons & Rivers Angels Follow Same Road Win Cup – Mission X

Nothing dey do for back, but e good make I dey alert because you no sabi wetin fit sup.”

Super Falcons wan nack Botswana next

Di next match, Nnadozie and her team go face Botswana on Thursday, July 10.

Botswana don lose 1-0 give Algeria and dem sabi Naija — di last time dem jam for WAFCON 2022, Falcons nack dem 2-0.

Wit dis WAFCON win, Naija babes don send beta warning: dem mean business, and Nnadozie dey ready for anytin wey go show face next.

  Edna Imade don win Liga F Player of the Month as Super Falcons matter still dey hang for wire
You Like this post abi?
Oya, we go like hear from you abeg. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 7, 2025 11:04 am by Hitvibz Media

Be the first to comment on "Chiamaka Nnadozie yarn on Super Falcons WAFCON win vs Tunisia: “We dey respect dem”"

Leave a Reply