Hull City don finally sign Nigerian baller David Akintola put for two-year contract, as dem wan ginger their attack for the new Championship season. Na correct firewood dem add to the squad be this one.

Nigerian winger David Akintola don join Hull City

And for Akintola, e no be small thing. Baba talk say na “dream come true” after him don waka play ball for different Europe corner, na weytin hitvibz dey yan be dat.

“Na Easy Decision” – Akintola Yarn After Joining Hull City

The 29-year-old winger no fit hide hin joy as e finally land for Hull City.

Akintola talk:

My people, I happy no be small to dey here. Few weeks ago dem show interest, na sharp sharp I gree. Na only visa waka delay me small because I dey Naija. But I don finally land, and I dey very grateful.”

“As I dey grow up for Naija, na Premier League full our TV. Hull self don play Premier League before, so na club wey I sabi well. To come play here now na privilege wey choke.”

“Everybody wey I meet here don welcome me well. Na dream come true, because every Naija boy dey dream to play ball for England. I ready to give everything make we run things this season.”

Hull City and Naija Ballers – E Get History

Akintola no be the first Naija pikin wey go wear Hull shirt o. Na number eight he be for the roll call.

  David Akintola Don Deliver Em First Assist as Hull City Fall Inside Well for Bristol

  Hull City.don announce David Akintola as dia new signing

We still dey remember when Austin “Jay-Jay” Okocha scatter Premier League and ginger Hull promotion for 2007.

Others wey don rep include Seyi Olofinjana, Hope Akpan, Dele Adebola, Sone Aluko, Ola Aina, and Semi Ajayi wey just sign this summer.

Naija blood dey run for that club steady.

From Europe to England – Akintola Don Hustle Well

This guy no be small pikin for ball. 270+ professional games dey hin back pocket. He start for Denmark with Midtjylland, before he dey waka go loan here and there.

  David Akintola Don Deliver Em First Assist as Hull City Fall Inside Well for Bristol

David Akintola Hull City dream move unveiled

For Norway, he scatter everywhere with Jerv, Haugesund and Rosenborg – even play Champions League qualifiers join.

He chop small ball for Cyprus with Omonia Nicosia before he blow for Turkey with Hatayspor, where he knack 7 goals + 7 assists for 2020/21.

Later, he carry body go Adana Demirspor, knock 13 goals for 77 matches and help dem qualify for Europe.

Recently, he dey ball for Çaykur Rizespor, where he give 4 goals and 9 assists for 49 games.

Baba don pay hin dues abeg.

Wetin Hull City Fans Fit Expect

  David Akintola Don Deliver Em First Assist as Hull City Fall Inside Well for Bristol

Hull fans, make una shine eye. Na pace, na creativity, na experience this guy carry come. He sabi beat defenders like say na street corner football, and hin pass dey always deadly.

If dem use am well, Akintola go fit turn Championship defenders to mumu and help Hull chase that promotion dream.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 16, 2025 12:06 pm by Hitvibz Media