Akor Adams no waste time at all to show Venezia fans the kain bad boy wey dem buy.

Akor Adams Venezia Coppa Italia debut performance

The Super Eagles striker put up masterclass performance with two sweet goals and one assist to chop Man of the Match as Venezia pull off 3-2 comeback win against Modena inside Coppa Italia, na weytin Hitvibz dey yan be dat.

Akor Adams Show Venezia Fans Say Im Machine Don Ready

Modena shock everybody for Stadio Pier Luigi Penzo as Giuseppe Ambrosino strike early for 17th minute.

But no be person like Akor dem dey shake — just nine minutes later, the Nigerian boy level matter 1-1 to make the stadium scatter with joy.

Ambrosino score again before half-time to put Modena 2-1 ahead, but Akor say “no be for my watch.” With seven minutes left for clock, the 25-year-old deliver sweet pass give John Yeboah to score equaliser.

  Taiwo Awoniyi show Chelsea pepper as e score two landmark goals, win penalty for Forest win

Akor Adams celebrates Venezia comeback victory over Modena

Three minutes after that, Akor come score the winning goal to complete the 3-2 comeback and push Venezia go next round.

As Serie A season dey start next Sunday against Lecce, Venezia fans already know say dem get serious goal machine.

Senior Man Iheanacho Fire Bursaspor To Another Victory

Senior Man Kelechi Iheanacho don quickly turn to the fan favorite for Bursaspor, and the guy give dem another reason to pop champagne on Saturday evening.

After e score for im debut last weekend, Senior Man score again as Bursaspor chop Igdir FK 1-0 for Matli Stadyumu.

Kelechi Iheanacho Bursaspor goal in Turkish 1. Liga

Fans no even sit down finish before the Nigerian star show im class. Just 17 minutes enter the match, Senior Man rise high inside 18-yard box, wire heavy header inside net wey leave goalkeeper lost.

That single goal na im decide the game and keep Bursaspor 100% record intact for the 2026/27 1. Liga campaign.

  Simy Nwankwo reach 26 goal contribution as Christian Ebere fire two goals for Cruz Azul victory

Two matches, two goals — that na the Senior Man standard so far for Turkey! Igdir FK try to bounce back, but things come spoil more for dem for 72nd minute when Alperen Selvi chop red card.

Bursaspor hold their ground till whistle blow, and now dem don secure full six points from six.

Durosinmi Light Up Comeback For Genk

Rafiu Durosinmi dey give KRC Genk fans big reason to dey happy as the 23-year-old striker score for second match back-to-back to inspire bad-gauge 3-2 comeback win over Westerlo for Cegeka Arena.

Rafiu Durosinmi penalty goal for Genk

Things look somehow for Genk early-early as Dylan Ourega score for Westerlo for 7th minute, and Matte Smets score own-goal four minutes later to put the visitors 2-0 up. But Durosinmi no panic.

Three minutes before half-time, the Super Eagles forward stand up for penalty spot, cold-bloodedly wire the ball enter net to drag Genk back enter the match.

  Victor Osimhen Don Score Again Before AFCON, Galatasaray Use Antalyaspor Do Saturday Rice

That penalty goal change the whole energy inside stadium, and Bryan Heynen quickly make am 2-2 before break.

Durosinmi hustle well before e commis for 70th minute for Aaron Bibout, wey later score the winner for 79th minute.

Two games, two goals for Durosinmi after im goal against Zulte Waregem last week — the boy don show say im move go Belgium na pure fire!

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 16, 2026 9:40 am by Hitvibz Media