The title race collect another gbege for Nigeria Premier Football League (NPFL) Matchday 17 as Rivers United climb go top after dem grind hard for home win, while plenty title contenders drop points for different parts of the country.
From Port Harcourt reach Yenagoa, late goals, away wins and tight-tight draws scatter both top and bottom of the table, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Wetin Happen for NPFL Matchday 17
Rivers United Don Climb Go Top
Rivers United don climb reach the top of Nigeria Premier Football League after dem manage beat Wikki Tourists 1–0 for Adokiye Amiesimaka Stadium, Port Harcourt, on Monday.
Na Taofeek Otaniyi score the only goal for the match for 19th minute take seal the win.
The victory push Rivers United unbeaten run reach nine matches. The Port Harcourt boys now dey lead the table with 33 points from 16 games, making dem the third team wey don sit for top this season.
Finidi George and him boys last lose match on October 12, when Bayelsa United beat dem.
Ikorodu City Draw for House
Meanwhile, Ikorodu City and Katsina United share points after dem play 0–0 for Mobolaji Johnson Arena, Onikan.
Even with the draw, Ikorodu City still hold third position for table, while Katsina United move go 11th with 22 points from 17 matches.
Rangers Grab Last-Minute Point for Benin
Enugu Rangers come from behind collect 1–1 draw against Bendel Insurance for Matchday 17 opener on Saturday.
Both teams wait reach late before dem act, as Promise Anyanwu score for Insurance with nine minutes left, before Chidozie Iwundu answer back for stoppage time make sure say points share.
Shooting Stars Pick Second Away Win
Shooting Stars carry full three points comot Kano after dem beat Barau FC 1–0 for Sani Abacha Stadium on Sunday. Na Sodiq Ibrahim score sharp-sharp for ninth minute. The result mean say na their second away win for this season.
Abia Warriors Carry Oriental Derby Go House
Abia Warriors too collect maximum points for away ground after dem edge Kun Khalifat 1–0 for Oriental derby. Suraju Lawal score the winning goal nine minutes to the end.
Bayelsa United Shock Remo Stars
Defending champions Remo Stars fall 2–1 to Bayelsa United for Yenagoa. Victor Mbaoma put Remo Stars ahead early, but Fabby Clark equalise before Emo James score the winner.
Nasarawa United Miss Chance to Climb Top
Nasarawa United lose chance to remain for top after Plateau United hold dem to 0–0 draw for Jos.
Wolves and Pillars Share Points
Warri Wolves and Kano Pillars settle for 0–0 draw for Ozoro, as both teams lock horns and cancel each other out for tough match.
Enyimba Don Return to Winning Mood
Enyimba beat Kwara United 3–1, as Samuel Agu and Chidera Michael score, while Toheeb Gidado reply for Kwara United.
Niger Tornadoes Scatter Everywhere for Minna
Niger Tornadoes tear El-Kanemi Warriors 3–0 for Minna. Rickson Mendos score two goals, while Azeez Akintunde add the third.
NPFL Matchday 17 Results Sharp-Sharp
Bendel Insurance 1-1 Enugu Rangers
Barau FC 0-1 Shooting Stars
Kun Khalifat 0-1 Abia Warriors
Bayelsa United 2-1 Remo Stars
Enyimba 3-1 Kwara United
Wolves 0-0 Kano Pillars
Niger Tornadoes 3-0 El-Kanemi Warriors
Plateau United 0-0 Nasarawa United
Rivers United 1-0 Wikki Tourist
Ikorodu City 0-0 Katsina United
Victor Mbaoma wey dey play for Remo Stars don pass Anas Yusuf for di league top scorer wahala with seven goals. Chidozie Iwundu dey second with six goals, and Anas sef get six too.
Table Standings: Hot Battle for Top After NPFL Matchday 17
Table Standings: Wahala for Bottom After NPFL Matchday 17
Wetin Dey Next After NPFL Matchday 17
Rivers United get tough away matches next, starting with Barau FC for Thursday before dem waka go face Katsina United on Sunday.
Ikorodu City go travel go Enugu Rangers, while Nasarawa United go try bounce back for house as dem host Barau FC later in the week.
As title race dey tighten and survival fight dey hot, the next set of matches go surely bring more drama for this NPFL season.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on December 16, 2025 8:41 am by Hitvibz Media






Be the first to comment on "Rivers United Don Climb Go Top as NPFL Matchday 17 Results Scatter Title Race"