Former naija youth baller and Kparabo Arierhi former teammate for Lillestrøm SK, Tochukwu Ogboji, don join Norwegian club Strømmen IF on loan.

Nigeria U-17 defender Tochukwu Ogboji in Norwegian football

Strømmen yarn am for their official social media page say dem don secure the young defender from Lillestrøm on loan, as the boy dey find more regular first-team game time, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Tochukwu Ogboji don land for Strømmen on loan

The Nigerian defender wey people dey call Tochi, make the move so he fit dey play steady football and face better competition pass wetin Lillestrøm fit give am for now.

Ogboji join Lillestrøm early 2025 after he impress during trial. The talented centre-back don represent Nigeria for U-17 level before, and plenty people see am as big prospect wey still get plenty room to grow.

Former Nigeria U-17 defender Tochukwu Ogboji in Strømmen jersey

As he dey rise steady for Norwegian football, e show say the boy serious about him progress for Europe.

Former Nigeria U-17 defender dey eye big breakthrough for Strømmen

Last season, the left-footed defender spend some time on loan for Mjøndalen, where he gather important experience for senior Norwegian football.

Now, na with Strømmen jersey him development go continue.

At just 19 years, Ogboji carry strong body, balance well for backline, and him left foot plus ability to play different defensive roles go give Strømmen more tactical options.

Tochukwu Ogboji joins Strømmen IF on loan

The club go dey hope say the former Nigeria U-17 defender go settle fast, grab him chance for the squad, and add more competition for the defence

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on February 12, 2026 8:56 am by Hitvibz Media