Super Eagles striker wey dey hot like fire, Victor Osimhen, don knack another goal again – him second for di season – as Galatasaray waka Rizespor 3-1 for Turkish Super Lig on Saturday evening.

Victor Osimhen scores for Galatasaray vs Caykur Rizespor

For di round four showdown wey shele for RAMS Park, Osimhen burst net with di second goal wey scatter di visitors head. Defending champions no even give Rizespor breathing space, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Victor Osimhen Weyyabi “Tormentor-in-Chief”

My guy Osimhen dey 26 but see as e dey run defenders like small pikin. Rizespor backline no fit rest, dem foul am four times – e still punish dem with him header wey confirm di game.

  Victor Osimhen Try Well Well but Napoli Still Chop Disappointing Defeat from Bologna

No be only am wey show face sha. Him Super Eagles brother, Ibrahim Olawoyin, run small hustle for Rizespor before dem comot am for 73rd minute give Muhamed Buljubasic.

Galatasaray players celebrate victory over Rizespor

How Di Goals Take Enter

Na Galatasaray draw first blood. Just 20 minutes gone, Davinson Sanchez fly like say na helicopter, nod ball pass keeper. One–zero.

Rizespor think say dem don equalise 14 minutes later as Qazim Laci blast rocket enter top corner. But VAR no gree – offside! Na so dem joy die before halftime.

Second half never too old, 65th minute Osimhen remind everybody say him na landlord.

Abdulkerim Bardakci drop one sweet cross, Osimhen rise like ladder, nod am into empty net. Two–zero. Fans nearly scatter stadium with noise.

  Henry Onyekuru dey happy say e join Gençlerbirliği: "Na my padi make me reason am"

This na back-to-back goals for am since e finally move go Galatasaray permanent. Last week, na Kayserispor chop 4-0, Osimhen still score there.

Rizespor still try get small respect back as Dal Varesanovic tap in rebound for 73rd minute. But na small pepper dem put for soup wey don already sweet.

Victor Osimhen header goal against Caykur Rizespor

Galatasaray Still Dey Run Things

Later Osimhen comot for Wilfried Singo, and just three minutes after, na Mauro Icardi finish work.

Di Argentine striker sharp like thief, control ball for box, hammer di third goal. Full-time: Galatasaray 3, Rizespor 1.

Na four wins in four games now. Galatasaray dey play like say league na warm-up. Next stop after international break – Eyupspor.

  “I Hate to Dey Lose” — Chibuike Nwaiwu React After Em First Assist as Trabzonspor Fall Hands vs Fenerbahce

If Osimhen continue this form, defenders go soon dey pray for injury excuse before dem face Galatasaray.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 30, 2025 10:24 pm by Hitvibz Media