Ademola Lookman show say em be world class player again as Atlético Madrid scatter FC Barcelona 4-0 for first leg of their Copa del Rey semi-final for Metropolitano.

Ademola Lookman in Copa del Rey semifinal

Match never even start well for Barca as Eric García put ball for him own net for sixth minute. Antoine Griezmann come add second goal for 14th minute, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Ademola Lookman dey shine as Atlético disgrace Barca

For 33rd minute, na Lookman make am three with cool finish. Before halftime whistle blow, Julián Álvarez score fourth after Lookman dash am correct pass.

Na serious first-half wahala for Barcelona.

Since Lookman land from Atalanta BC for winter transfer, guy don already get four goal contributions — two goals and two assists — inside three matches. Na serious baller be that.

Lookman talk wetin really matter after di Barca beating

After him first home goal for Atlético, Lookman no hide him joy but still put team first.

  Victor Osimhen Don Strike Again as Galatasaray Scatter Başakşehir to Hold Dem Super Lig Tight

Ademola Lookman in action for Atlético Madrid vs Barcelona

“I dey very, very happy. E sweet to score, no doubt, but I think say the way the team play tonight na top level. For both ends of the pitch, we sharp and clinical, and the togetherness we show today correct well well,” Lookman yarn for Sporty TV.

“We collect that energy from our fans tonight, dem too much, so we really glad.”

When dem ask am if he plan to score against Barcelona, he clear say striker work na to dey find goal always.

“As attacker, you go always wan score. You dey always find way enter dangerous position, so I just dey try show for the right place at the right time.”

Lookman still yarn say before match start, everybody for dressing room know wetin dem suppose do.

  Ex-Enyimba star Chibuike Nwaiwu don join Paul Onuachu for Super Lig big boys Trabzonspor

Wetin dem expect from us clear well well. We know wetin we suppose do today because the matter serious die. Today na match wey we gats enter field go show wetin we carry, and we really show am. Na correct performance.”

Even with the big win, Lookman say focus never shift.

No doubt, na big win. But we still get some matches before we go play dem for their ground, so we gats keep the same mindset and same focus for those games. Na those matches go carry us reach the other semi-final. We dey look forward to the days wey dey come.”

He still hail him teammates, especially the attacking stars.

Ademola Lookman reacts after scoring in Copa del Rey semifinal

Dem be correct, correct players wey get crazy skills and talent. E sweet well well to play wit players like dis, to dey work together and get same goal to win. Na tori wey matter pass.”

Right now, Ademola Lookman dey hot for Copa del Rey, and e clear say Atlético don get serious weapon as dem dey push for trophy.

  Emmanuel Fernandez Carry Rangers W, Godwin Show Say Him Dey on Fire for UAE
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on February 13, 2026 5:22 am by Hitvibz Media