Nigeria go miss one of their key defenders, Ashleigh Plumptre, for the 2026 Women’s Africa Cup of Nations (WAFCON) after dem no include her for the Super Falcons squad wey dem announce on Friday.

Ashleigh Plumptre sends message to Super Falcons ahead of 2026 WAFCON

Di 27-year-old defender no make di final 25-player squad wey Super Falcons head coach, Justine Madugu, release for di continental tournament, na weytin Hitvibz dey yan be dat.

Ashleigh Plumptre Misses 2026 WAFCON Because of Foot Injury

Plumptre don confirm say she still dey recover from foot injury, and she decide say make she focus on getting fully fit because her body still need more time before she fit return to competitive football.

  Nicole Payne Come Back From ACL Injury, Score First Pro Goal as Orlando Pride Shock San Diego Wave

Di former Leicester City defender talk say e pain her wella say she no go feature for one of Africa’s biggest women’s football tournaments, but she still believe say she go wear Nigeria jersey again once she recover completely.

Super Falcons defender Ashleigh Plumptre recovering from foot injury

Instead make she dey reason say she no go play, Plumptre beg Nigerians make dem stand gidigba behind di Super Falcons as dem begin chase their record 11th WAFCON title.

She still tell fans make dem dey patient with di team and continue to support and encourage dem throughout di competition.

Super Falcons Defender Send Emotional Message Give Nigerians

For message wey she post for her X account, Plumptre write:

  Esther Okoronkwo Carry WAFCON Fire Enter NSL, Scatter Montreal Roses for AFC Toronto Win

The body is asking for more time and I’m listening. Sad to be missing this WAFCON yet hopeful in the prospect of getting to fight alongside these women again with the support of Nigerians everywhere when the body is ready to compete again.

So, in the meantime, back these women, back them on their quest for victory once more. Go easy on them, they need you. I am with you ladies. Naija no dey carry last.”

Ashleigh Plumptre reacts after missing 2026 WAFCON squad

Plumptre first play WAFCON for di 2022 edition wey Morocco host.

Her absence fit affect Nigeria well because she don become one of di most important defenders for di Super Falcons.

  Gift Monday open account with late goal as Washington Spirit wire Asisat Oshoala former club

Di defender still dey among di Super Falcons players wey help Nigeria win dia 10th WAFCON title after dem beat Morocco 3-2 for one dramatic final.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 11, 2026 9:50 am by Hitvibz Media