Super Eagles striker Kelechi Iheanacho finally show face again for Celtic as dem collect heavy 4–1 beating for house from Stuttgart on Thursday night for Europa League.

Kelechi Iheanacho returns for Celtic vs Stuttgart Europa League

The naija forward enter from bench for 71st minute, na im first match since early February when he manage play small against Falkirk, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Kelechi Iheanacho No Really Make Impact for Celtic

Injury wahala bin sideline am for recent league matches against Livingston and Kilmarnock.

Even as he come back, e no change anything as Stuttgart control the game well well. Bilal El Khannouss score first before Benjamin Nygren equalise small.

But Stuttgart answer quick quick, as El Khannouss head in Angelo Stiller cross. After halftime, Jamie Leweling add another goal, before Tiago Tomás seal the win with better finish.

  Fisayo Dele-Bashiru Show Skills, Chop Better Assist as Lazio Pip Bologna for Coppa Italia

Iheanacho wey land Glasgow last summer after him time for Manchester City, don face plenty injury for him first season, and e don only play few league matches.

But as he don return now, fans dey hope say e go regain form sharp sharp and start to make better impact for coming weeks.

Aina Dey Shine as Forest Scatter Fenerbahce

Nottingham Forest dominates Fenerbahce with Ola Aina heroics

Naija defender Ola Aina play full part as Nottingham Forest hammer Fenerbahce 3–0 away for first leg of their Europa League play-off.

  Samuel Chukwueze Give Second Assist, Help Fulham Knock Tottenham, Shine as MOTM

The strong performance for Istanbul don put Forest for good position to qualify for last 16, and e give new coach Vitor Pereira sweet start as e just take over the team during one kind rough season.

Murillo, Igor Jesus, and Morgan Gibbs-White score the goals wey make the night special.

Ola Aina celebrates victory with Nottingham Forest against Fenerbahce

Now Forest be strong favourites to move forward, except miracle happen for second leg at the City Ground. If dem finish the job, dem go face either Real Betis or FC Midtjylland next round.

  Algeria vs Nigeria: Big Boys Go Jam Like Dangote Trailer for AFCON Quarter-Final
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on February 20, 2026 8:08 am by Hitvibz Media