The way house rent rent for Rivers State just take dey climb anyhow, e don even tall pass iroko and everybody don dey yan say di state government gatz step in to check am. People dey fear say if nothing happen, plenty tenants go dey suffer am.
According Nigeria Info FM wey talk to one human rights lawyer Courage Nsirimovu wey dey Port Harcourt, em yan say e no go easy for government to control how rent dey waka, especially with the kain economy we dey run for Naija now, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Rivers State House Rent Don Jump Bridge, Tenants Dey Cry
E yan this one for interview with their reporter, dey explain why e hard to control rent wahala.
Nsirimovu, wey be Coordinator for PILEX Centre for Civil Education, talk say e dey fear how landlords and landladies dey increase rent anyhow.
The lawyer ask Rivers State House of Assembly make dem think about to put law wey go control house rent.
Experts Dey Call for Serious Law Intervention
Also, Green Isaac, wey be Executive Director for Relief International Africa, join mouth talk say di State lawmakers gats rush put law make dem stop how rent dey high for the State.
The most annoying part be say anytime tenant complain say dem don increase him rent, landlords go just yan say “building materials don high, say na why”.
Abeg, weytin concern building material with house wey tenant don already dey live inside since?
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on January 30, 2026 10:51 am by Hitvibz Media



Stay connected