Super Eagles striker Akor Adams show say him no forget ball as e return to club action Monday night, knack two goals wey help Sevilla collect 2-2 draw for Elche ground, Manuel Martínez Valero Stadium.
The Nigerian striker enter the game from bench, come turn the match upside down, drag Sevilla commot loss with strong late performance, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Akor Adams change game for Sevilla
As second half start, coach bring Adams enter to replace Gerard Fernández, and everything change sharp sharp.
Him energy ginger Sevilla attack, confuse Elche defence, and visitors begin press with better confidence.
For 75th minute, Adams pull one back as e gently beat Elche keeper Iñaki Peña, wey Barcelona loan give dem. That goal quiet the home fans and make the match hot enter final minutes.
Akor Adams carry AFCON ginger enter La Liga
For deep inside stoppage time, Akor Adams seal him big night. For second minute of added time, him stand for penalty spot hammer correct shot enter roof of net to equalise. Na so him complete two goals within 25 minutes.
The two goals don carry Adams La Liga record go five goals and two assists for 15 league matches this season.
E show say him still dey hot after him better run for 2025 AFCON with Nigeria, where e score two goals and give two assists for seven matches as Super Eagles win bronze medal.
For Sevilla, the draw help dem waka comot relegation zone small, and once again Akor Adams show say him fit make difference as dem dey find league stability.
“I come back for this match after long tournament, the team need me, and e good say coach give me minutes make I boost the team and help us catch the draw,” Akor yarn to mundodeportivo.com.
“I think dem let small small things waka. We play better game we suppose don win. Elche na correct team, but we get plenty chances and I believe we fit don win.
“The main thing na the team. I don dey watch all the games while I dey outside, and the results no too sweet. We manage draw, I score, and I happy for the team. Now, we dey focus on wetin dey next,” Akor talk as mundodeportivo website quote am.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on January 20, 2026 10:10 am by Hitvibz Media



Stay connected